Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Nahum 3

1 E no go better for the city of murderers. Na lie full city of Nineveh. Na things wey dem dey take from other countries full am. Na people wey dem pursue and kill full am.

2 Una fit hear as whips and wheel dey sound. Una fit hear horses dey gallop and as chariot dey bounce join am!

3 Soldiers on top horses dey attack, their sword dey shine, their spear dey shine bright! Dead body full everywhere, dead body wey no get number - people dey fall on top them.

4 All this dey happen because of Nineveh. Nineveh be like prostitute wey no dey get satisfied. Shey dey want more and more. She sell herself give many nations, and she dey use her magic take make them her slaves.

5 Almighty God talk say, “I go punish you, Nineveh! I go naked una and I go allow people see una shame.

6 I go throw dirty things on top una and treat una bad, people go look una and dem go laugh.

7 Everyone wey see una go shock. Dem go talk say, ‘Nineveh don perish. Who go cry for her?’ I know say I no fit find any person to comfort una, Nineveh.”

8 Nineveh, shey una better pass Thebes, Egypt capital? She too get water to dey protect am like wall - the Niles na her defence.

9 Her power no get limit, she rule for Ethiopia and Egypt; Libya and Sudan dey support am,

10 yet dem carry people of Thebes go strange land. For every corner of the street, dem dey beat their children to dealth. Dem use chain carry their leaders commot and divide them among theirself.

11 Nineveh, una too go dey drunk! Una go try escape from una enemies.

12 But Nineveh, all una strong places go be like fig trees with ripe figs: when una shake the trees, the fruits go fall for una mouth!

13 Una soldiers be like women and una country no get defence for her enemies. Fire go destroy the bars for una gates.

14 Get water and store am for your city, because enemy soldiers go surround the city. Make una defence dey strong! Get clay to make brick and make una get the brick ready!

15 No matter wetin una do, fire go still burn una to dealth or die for battle. Una go be like crop wey locust chop. Una dey increase like insects!

16 Una get plenty traders wey dey go places go buy things, and dem plenty like stars wey dey sky! But now, dem don go, like locust wey come chop and commot after everything don finish.

17 Una official be like plenty locusts wey stay inside wall for cold day. But when sun come out, dem fly commot and nobody know where dem don go!

18 Emperor of Assyria, una governors don die, and una noblemen don sleep forever! Una people don scatter on top mountains, and no one go bring dem come home again.

19 Solution no dey to una injuries, and una wound no fit heal. All those wey hear about una destruction dey clap their hands. Dem dey happy, because na all of them feel the pain wey una cause again and again

Open Bible reader