Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Nahum 1

1 This one na message about Nineveh, the account of vision wey Nahum wey come from Elkosh see.

2 The LORD God no dey allow rivals; he dey punish those wey no follow am, and he dey pay them back with him anger.

3 God dey powerful, but he no dey quick vex and dey punish those wey dey sin. Where God waka, storm dey rise there; na cloud be the dust wey him feet raise.

4 He command the sea, and the sea dry! He dey make river dry. He dey make field of Bashan dry, Mount Carmel dey turn brown, and the flower of Lebanon dey fade.

5 Mountain dey shake for him presence; hills dey melt before him. Earth dey shake when God show; the world and the people wey dey inside am dey fear.

6 When he dey vex, who fit survive am? Who fit survive him terrible anger? He pour out him anger like fire; rocks dey turn dust before him.

7 God na good God, for time of trouble he dey protect him people; he dey take care of people wey turn to him.

8 He destroy him enemy completely like great flood wey dey flush; he kill those people wey no follow him.

9 Wetin una dey plan against God? He go destroy una. Nobody fit oppose am pass one time.

10 Drunkards, he go burn una, like thorns and straw wey don dry.

11 Someone from Nineveh dey plan evil against God.

12 This na wetin God tell him people Israel: “Even though Assyrians plenty and strong, dem go perish and disapper. My people I don make una suffer but I no go do am again.

13 Now, I go end Assyrians power on top una and I go break the chain wey bind una.”

14 This na wetin God don talk about Assyrians: “Dem no go get descendant wey go dey answer their name. I go destroy the idols wey dey for temple of their gods. I dey prepare grave for people of Assyria - dem no suppose dey live!”

15 Look, a messanger dey come on top the mountains with good news! He dey him way to come announce victory! People of Judah, make una celebrate una festival and give God wetin una don promise him. The wicked no go attack una land again. All of them don destroy!

Open Bible reader