Nigerian Pidgin Bible
Matthew 5
1 Wen Jisos si di pipol, e kon klimb go di mountin top and en disaipols folo am. Afta e sidan,
2 e kon bigin tish dem sey;
3 God go bless una wey dey poor for spirit, na una go get hevun.
4 God go bless una wey dey mourn, bikos e go mak una hapi.
5 God go bless una wey nor dey kari bodi up, una go enjoy en promis for dis wold.
6 God go bless una wey dey laik to du gud tins, e go giv una evritin wey una wont.
7 God go bless una wey dey sori for pipol, una go risiv mesi.
8 God go bless una wey get pure heart, na una go si God.
9 God go bless una wey dey mak peace, pipol go kol una God shildren.
10 God go bless una wey dey sofa bikos una dey du wetin dey rite, na una go enjoy God Kindom for hevun.
11 God go bless una wey pipol dey kos, dey sofa and lai for una head bikos of mi.
12 Mak una hapi and mak bele swit una, bikos na big tin dey wait una for hevun. Mak una rimemba sey, na so di profets wey kom bifor una, sofa tu. �
13 Na una bi salt for dis eart. Bot if salt nor get taste; haw e go bi for pipol mout? E beta mak dem trowey-am and mak pipol mash-am.
14 Na una bi lite for dis wold and tawn wey dey on-top mountin, nor dey hide.
15 Pesin nor dey lite lamp kon kova am wit bazin, insted e go put am for wer evribodi wey dey insaid di haus go si-am.
16 Laik dat tu, mak yor lite shine wel-wel for wer pipol dey, so dat dem go si di gud tins wey yu dey du, wey go mak dem praiz yor Papa wey dey hevun. �
17 Mak una nor tink sey I kom spoil Mosis Law and di tins wey di profets tish. Nor bi so, misef kom obey dem.
18 I tel una tru wod, bifor dis wold go end, evritin wey dey insaid di Law, ivun di smol-smol won, go hapun.
19 So enibodi wey nor du wetin God komand and dey tish odas to du as e dey du, naim go smol pas for God Kindom. Bot pesin wey obey God and tish odas to du wetin di Law tok, na big pesin e go bi for God Kindom.
20 I tel yu di trut, if di gud wey yu du, nor beta pas wetin di Farisi and di pipol wey dey tish di Law du, yu nor go fit enta God Kindom. �
21 Yu hear as God tel awa papa dem bifor-bifor sey, 'Nor kil and enibodi wey kil, God go joj am.'
22 Bot I tel una, enibodi wey ves for en broda, God go joj am tu. Enibodi wey kos en broda, go face di konsol and enibodi wey kol pesin, 'Mumu', go-go hell fire.
23 If yu tak gift go altar and yu kon rimemba sey yor broda get bad bele for yu,
24 mak yu liv di gift for di altar, first go setol wit yor broda, den yu go fit kom bak kon giv yor gift.
25 Kwik setol wit hu dey akiuz yu bifor una rish kourt, if not, e go giv yu to di joj and di warda go trow yu insaid prizin.
26 I tel una di trut, yu nor go komot from dat trobol ontil yu pay all di moni! �
27 Yu hear wey pipol sey, 'Mak yu nor slip wit hu yu nor mari.'
28 Bot I dey tel una naw sey, 'Enibodi wey luk wuman kon get di maind to slip wit am, don alredi komit sin for en heart.'
29 If yor rite eye go mak yu sin, mak yu plok am komot. E beta sey won part for yor bodi nor dey, dan sey all yor bodi enta hell fire.
30 If yor rite hand go mak yu du bad tin, mak yu kut am trowey! E beta sey won part for yor bodi nor dey, dan sey all yor bodi enta hell fire. �
31 Pipol dey sey, 'Enibodi wey driv en wife, must gi-am paper sey e nor won mari am again.'
32 Bot I dey tel una naw sey, enibodi wey driv en wife komot from marage, wey nor bi sey di wuman slip wit anoda man, don mak di wuman komit adultri and eni man wey mari di wuman, don komit adultri tu. �
33 Again, yu don hear sey dem tel pipol bifor-bifor sey, 'Mak yu nor break yor promis, bot du wetin yu promis God.'
34 Bot I dey tel una naw sey, mak una nor eva yuz hevun swear at all, bikos na God throne e bi,
35 or wit eart, bikos naim God dey put en leg, or yuz Jerusalem, bikos na di big king tawn e bi.
36 Nor ivun yuz yor head swear, bikos yu nor fit mak won singol hair white or blak.
37 Wen yu sey, 'Yes,' mak yu min am and wen yu sey 'No,' mak yu min am tu. Eni oda tin wey yu tok pas dis, na devol e from kom. �
38 Una hear sey, 'Enitin enibodi du una, mak una du-am bak.'
39 Bot I tel una, mak una nor fite, if enibodi slap yor face, turn di oda side gi-am tu.
40 If enibodi drag yor shirt wit yu, mak yu gi-am yor koat join.
41 And if enibodi fos yu waka won mile, mak yu folo am waka tu mile.
42 Giv pipol enitin wey dem ask from yu and nor driv enibodi wey kom boro somtin from yu. �
43 Una hear sey, 'Mak una luv una nebor and hate una enemi.'
44 Bot I tel una naw sey, 'Mak una luv una enemis and pray for pipol wey dey sofa una,
45 so dat una go bi laik una Papa for hevun wey dey alow sun to shine and rain to fal on-top bad and gud pipol.
46 �If una luv onli di pipol wey luv una, wetin una go gain?Na so bad pipol dey du tu, abi nor bi so?
47 �If una dey grit onli una brodas, una nor beta pas odas, bikos pipol wey nor no God stil dey du laik dat, abi nor bi so?
48 �So mak una dey pafet as una Papa wey dey for hevun, pafet."