Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 4

1 Di Holi Spirit tak Jisos go insaid desert mak devol for tempt am.

2 Afta Jisos don fast for forti days and forti nites, e kon dey hungri.

3 Den devol kon mit am sey, "If yu bi God pikin, komand dis stone mak e turn to bread. “

4 Jisos kon ansa, "God wod sey, 'Nor bi onli fud man go tak sovaiv, bot na wit evri wod wey God tok.' “

5 Den, devol show Jisos di tawn wey dey holi, kon mak am stand on-top di place wey high pas for di Tempol

6 and e tel Jisos, "If yu rili bi God pikin, jump go dan, bikos dem rite for God wod sey, 'God go komand en angels mak dem du evritin for yu and dem go kash yu mak yor leg nor nak stone.' “

7 Jisos ansa am, "God wod sey, 'Mak yu nor trai God wey bi yor Oga.' “

8 Den devol tak Jisos go won mountin wey high wel-wel, kon show am all di kindom for dis wold and all di beta tins insaid am.

9 Devol kon tel am, "I go giv yu all dis tins, if yu go fal for groun woship mi. “

10 Jisos ansa, "Komot here, devol! Bikos dem rite for God wod sey, 'Na onli God wi sopoz to serv and woship.' “

11 So, devol kon liv Jisos and God angels kon bigin help am.

12 Wen Jisos hear sey dem don put Jon insaid prizin, e kon go bak to Galili.

13 From der, Jisos komot from Nazaret go Kapanum wey near di sea, wer Zebulun and Naphtali pipol dey stay,

14 so dat wetin Profet Isaia tok, go hapun:

15 “Zebulun and Naphtali, di place wer riva for kros Jordan go Galili, wer pipol wey nor bi Ju dey stay,

16 una wey dey daknes, don si big lite and una wey don nearli die, don get life. “

17 From dat taim, Jisos bigin prish sey, "Mak una turn from sin kom mit God, bikos God Kindom don kom mit una. “

18 As Jisos dey waka for Galili wotasaid, e si tu brodas: Saimon wey dem dey kol Pita and Andru en broda, dem dey trow net insaid di riva dey kash fish.

19 Jisos kon tel dem, "Mak una folo mi and I go mak una kash pipol. “

20 At wons, dem liv dia net kon folo Jisos.

21 As Jisos komot from der, e kon si tu brodas, James and Jon, wit Zebedi dia papa, dey ripair net insaid dia boat. Den Jisos kol di brodas.

22 Kwik-kwik dem run liv dia papa insaid di boat, kon folo Jisos.

23 Jisos kon dey waka for Galili dey tish insaid dia sinagog. E prish abaut God Kindom and dey heal pipol wey get difren-difren diziz and siknes.

24 So di news abaut Jisos kon spread go evriwer for Syria. Dem kon bring pipol wey nor wel, wey nor fit waka, pipol wey devol dey wori and di pipol wey dim on dey insaid dem, kom mit am and e heal all of dem.

25 Meni pipol from Galili, Dekapolis, Jerusalem, Judea and pipol wey dey stay near Jordan Riva, kon folo am.

Open Bible reader