Nigerian Pidgin Bible
Matthew 26
1 Wen Jisos tish finish,e kon tel en disaipols,
2 Mak una no sey na tu days remain bifor di Passova go start and dem go giv Man Pikin to pipol wey go nail am for kros.
3 Di prist oga dem and di eldas kon hol mitin wit Kaifas, di High Prist, for en palise.
4 Dem kon plan for sikrit to arres Jisos mak dem for kil-am.
5 Bot dem kon sey, "Mak wi nor du-am wen di Fist don start, so dat pipol nor go mak trobol.
6 Naw, as Jisos dey Betani for Saimon, wey bi lepa, haus,
7 won wuman bring kontaina wey get oil wey dear wel-wel, kon pour di oil for Jisos head as e sidan for tabol dey chop.
8 Wen di disaipols si wetin hapun, dem kon ves wel-wel, ask di wuman, "Why yu dey waste dis oil?
9 E for beta pas sey dem sel am kon giv di moni to poor pipol!
10 Wen Jisos hear wetin dem tok, e kon sey, "Why una dey trobol dis wuman? Na beta tin e du for mi -o-o!
11 Poor pipol dey wit una evritaim, bot mi, I nor go dey wit una always!
12 Wen di wuman pour dis oil for my bodi, e dey priper mi for my beria.
13 I tel una tru wod, eniwer dem go dey prish di gospol, dem go tak dis tin wey di wuman du so tak rimemba am for di hol wold.
14 Den Judas Iskarot, wey dey among di twef disaipols go mit di prist oga dem,
15 kon tel dem, "Wetin una go giv mi, if I sel Jisos Kraist giv una? So dem kon kount tati (30) silva koins gi-am.
16 From dat taim, Judas kon dey faind haw e go tak sel Jisos Kraist.
17 For di day wen dem start di Fist for di Bread wey nor get yist, di disaipols kom mit Jisos Kraist tel am, "Tel us wer yu for wont chop di Passova Fud, so dat wi go-go priper di place.
18 Jisos tel dem, "Mak una go insaid di tawn and una go mit won man. Mak una tel am, 'Di tisha sey, "My taim don rish. I go chop di Passova Fud wit my disaipols for yor haus.'
19 So di disaipols du as Jisos tel dem, den dem kon go priper di Passova Fud.
20 Wen evenin rish, Jisos sidan for di tabol wit en twef disaipols.
21 As dem dey chop, e kon sey, "I tel una tru wod, won of una go sel mi
22 Wetin e tok kon wori dem wel-wel, so dem kon bigin ask am, "Oga, na mi?
23 Jisos kon ansa, "Na di pesin wey go put hand insaid plate wit mi, na-im go sel mi.
24 Man Pikin go die as dem rite abaut am, bot kos dey di pesin head wey go sel am! E for beta sey dem nor born di pesin at-all.
25 Den Judas, di pesin wey go sel am, kon sey, "Tru-tru, Oga, na mi yu dey tok abaut? Jisos kon ansa am, "Yu don tok am.
26 As dem dey chop, Jisos tak bread kon tank God, afta e divide am, e giv en disaipols, kon sey, "Mak una chop, dis na my bodi.
27 Afta, e tak di cup kon tank God, e giv dem, kon sey, "Mak all of una drink from am,
28 bikos dis na my blood, wey bi di kovenant wey go mak God forgiv pipol dia sins.
29 I tel una, from naw go, I nor go drink dis wine ontil di day wey I go drink di new wine wit una for my Papa kindom.
30 Afta dem sing won hymn, dem komot kon go Mount Olives.
31 Den Jisos kon tel dem, 'Dis nite all of una go run liv mi, bikos dem rite for God wod sey, 'I go kil di shepad and di ship go skata.'
32 Bot afta God don raiz mi up from deat, I go-go Galili, go wait for una.
33 Pita kon ansa am, "If odas run liv yu, mi, I nor go eva liv yu!
34 Jisos kon tel am, "I tel yu di trut, for dis nite, bifor fawo go du 'Kukuruku', yu go denai mi tiri taims.
35 Pita stil ansa, "Ivun if I go die, I nor go eva denai yu". And all di disaipols tok di same tin.
36 Den Jisos kon go Getsemani wit en disaipols, kon tel dem, "Mak una sidan here bikos I wont kros go di oda side go pray.
37 E tak Pita, James and Jon, wey bi Zebedi tu shildren, wit am. Bot bikos of wetin won hapun, bele nor swit am.
38 Den e tel dem, "My heart heavi and e bi laik sey I won die. Mak una stay here and wosh wit mi.
39 E waka go front smol, kon laidan face groun, den kon pray, "My Papa, if yu wont, yu go fit rimov dis deat from mi! Bot nor bi as I wont, na as yu wont am.
40 Wen Jisos kom bak, e kon si sey all en disaipols dey slip. Den e ask Pita, "So yu nor fit stay mak yu nor slip for won hour?
41 Opun yor eye mak yu pray, so dat yu nor go fal insaid temtashon. Yor spirit won du-am, bot yor flesh dey wik.
42 Jisos kon go pray for di sekon tiam, "My Papa, if Yu nor won tak dis deat komot unles I die, den mak wetin Yu wont hapun.
43 E kom bak kon si en disaipols dey slip again; dem nor fit opun dia eyes.
44 So e liv dem, go pray di same way for di ted taim.
45 Den e kon mit di disaipols ask dem, "Una stil dey slip and res? Si, di taim don dey rish wen dem go sel Man Pikin giv sinas.
46 Mak una stand up, mak wi dey go. Si! Di pesin wey won sel mi, don dey kom!
47 As Jisos stil dey tok, Judas wey bi won of di disaipols, kon kom. Plenti pipol wey di prist oga dem and eldas send and wey kari gun and big stick folo am kom.
48( Naw, di pesin wey sel am, don giv dem sign sey, "Di pesin wey I go kiss, naim bi di man. Mak una arres am!")
49 At wons, e go mit Jisos, grit am, kon sey, "Tisha", den e kon kiss am.
50 Jisos kon tel am, "My frend, du wetin mak yu kom". Den dem hol Jisos kon arres am.
51 Bot won of di disaipols wey dey wit Jisos draw en sword kom out, kon kut di High Prist slave ear komot.
52 Den Jisos tel am, "Put yor sword for wer e dey bifor! Bikos enibodi wey dey kari sword, na sword go kil-am.
53 Yu tink sey, I nor fit kol my Papa sey mak e send meni angels kom help mi naw-naw?
54 Bot if I du-am, wetin dem rite for God wod abaut dis mata, nor go hapun?
55 By dis taim, Jisos tel di pipol, "Una kari sword and stick kon arres mi laik sey I bi tif? I dey tish insaid di Tempol evriday, bot una nor arres mi.
56 Dis won hapun so dat wetin di profets rite for book go bi tru. Den all di disaipols kon run liv am.
57 Naw di pipol wey arres Jisos tak am go mit Kaifas di High Prist, wey di law tishas and eldas don gada for en haus.
58 Bot Pita folo dem go rish di High Prist yard. E kon sidan wit di gaids to si wetin go hapun.
59 Di prist oga dem and di Sanhedrin kon dey faind wetin dem go tak hol Jisos, mak dem for fit kil-am.
60 Bot dem nor si enitin to tak hol am, ivun doh meni pipol kom lai against am. At last, tu pipol kom out
61 kon sey, "Dis man sey, 'I go fit distroi God Tempol and build am again for tiri days'".
62 So, di High Prist kon stand up ask am, "Yu nor get eni ansa? Wetin bi dis wey dem dey tok against yu so?
63 Bot Jisos kwayet. Den di High Prist kon tel am, "I tak God name komand yu to tel us if yu bi Kraist, wey bi God Pikin.
64 Jisos ansa am, "Yu don tok am. Bot I tel yu, from naw go, yu go si Man Pikin sidan for God rite hand dey kom dan for kloud from hevun.
65 Den di High Prist tear en klot, kon sey, "E don tok against God! Why wi stil nid anoda witnes? Una don hear as e tok against God!
66 Wetin una tink? Dem kon ansa, "E du bad and e sopoz to die.
67 Dem kon spit for en face, beat am and som slap am,
68 dey sey, "Mak yu tel us wetin go hapun, Yu wey bi Kriast! Na hu beat yu?
69 As Pita sidan outsaid for di yard. Won girl wey bi savant kon tel am, "Yu sef bin dey wit Jisos Kraist wey kom from Galili.
70 Bot Pita denai am for evribodi front kon sey: "I nor no wetin yu dey tok abaut!
71 Wen e komot go outsaid, anoda girl wey bi savant si-am, kon tel di pipol wey dey der, "Dis man sef dey wit Jisos wey kom from Nazaret".
72 Pita kon swear denai again, "I nor no di man!
73 Afta somtaim, pipol wey stand for der, kom mit Pita tel am, "Yu rili bi won of dem, ivun di way yu dey tok show sey yu dey wit am!
74 As e hear dis won, Pita kon dey swear, "I nor no di man! Dat same taim, fawo kon mak "Kukuruku".
75 Den Pita kon rimemba wetin Jisos tel am, "Bifor fawo go mak 'Kukuruku', yu go denai mi tiri taims. Den Pita kon go outsaid bigin krai.