Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Matthew 18

1 Dat taim, di disaipols kon ask Jisos, "Na hu big pas for God Kindom? “

2 Jisos kon kol won pikin stand for dia front,

3 den e ansa, "I tel una tru wod, unles una bi laik smol pikin, una nor go fit enta God Kindom!

4 “Enibodi wey bring ensef dan laik dis smol pikin, naim big pas for God Kindom.

5 “Enibodi wey welkom won pikin laik dis won for my name, welkom mi.

6 “Bot if enibodi mak won of dis smol shildren wey biliv mi komit sin, e beta mak dem tie grindin stone for en neck, mak e for sink insaid riva.

7 “Wahala dey for dis wold, bikos of di sin wey pipol dey komit! Na tru sey trobol must kom, bot e go bad for di pesin wey go kause di trobol.

8 “If yor hand or leg dey mak yu sin, mak yu kut am trowey. E beta mak yu enta God Kindom witout hand or leg, dan sey God trow yu insaid fire wey nor dey kwensh.

9 “If yor eye dey mak yu sin, mak yu pul am trowey. E beta mak yu enta God Kindom wit won eye, dan sey God trow yu enta hell fire wit tu eyes. “

10 “Mak sure sey una nor porshu eni of dis smol shildren komot. I tel una di trut, dia angels dey my Papa front for hevun evritaim.

11 “Bikos Man Pikin kon save pipol wey loss.

12 “Wetin yu tink? If pesin get ondred ship and won waka loss, e nor go liv di ninety-nine for di bush go faind di won wey loss?

13 “I tel una tru wod, wen e si-am, e go hapi for dat won pas di ninety-nine wey nor loss.

14 “Na laik dis tu yor Papa for hevun nor wont mak eni of en shildren loss. “

15 “If yor broda du yu bad, mak yu go tel am wetin e du. If e asept wetin yu tel am, yu don win yor broda bak bi dat.

16 “Bot if e nor asept wetin yu tok, tak won or tu pipol folo bodi go mit am, bikos mata wey tu or tiri pipol tok put, naim beta pas.

17 “If e nor asept wetin dem tok, mak yu tel di shosh lidas. If e nor gri listin to wetin di shosh lidas tok, den mak una trit am laik sina or tax koletor.

18 “I tel una tru wod, enitin wey una tak praya tie for eart, God go tie am for hevun and enitin wey una tak praya tie luz for eart, God go luz am for hevun.

19 “Again, I tel una tru wod, if tu of una for dis wold gri and pray for enitin, my Papa for hevun go du-am for una.

20 “Eniwer tu or tiri pipol gada for my name, I go dey der wit dem. “

21 Den Pita kon ask Jisos, "Oga, haw meni taims I go forgiv my broda wey du mi bad? Na sevun taims? “

22 Jisos ansa am, "Nor bi onli sevun taims I tel yu, bot na for-ondred and ninety taims! “

23 “God Kindom bi laik wen won king won no haw en savants dey manage en biznes.

24 “As di king dey shek di account, dem kon bring won savant, wey dey hol ten tazon koins kom.

25 “Bikos e nor fit pay wetin e hol, di king kon orda mak dem sel di man, en wife, en shildren and evritin wey e get, to pay di debt.

26 “So, di savant fal for di king front dey beg, 'Oga, mak yu dey patient wit mi, I go pay yu evritin.'

27 “Di king sori for di savant, kon riliz am sey mak e nor pay again.

28 “Afta, di same savant kon si anoda savant wey dey hol am ondred silva koins. E kon seize am for trot nearli kil-am, kon tel am, 'Pay mi my moni.'

29 “Di savant wey e seize for trot kon fal for groun dey beg am, 'Mak yu dey patient wit mi, I go pay yu yor moni.'

30 “Bot e nor gri. Insted e kari am go put for prizin, ontil e go pay wetin e hol.

31 “Wen di oda savants si wetin hapun, dem nor hapi at all, so dem kon go tel di king evritin wey hapun.

32 “So di king kol di first savant kon tel am, 'Yu wiked savant! I forgiv yu di big debt wey yu hol mi, bikos yu beg!

33' Wetin mak yu nor sori for anoda savant laik yu, jos as I sori for yu?'

34 “Wit vesnashon, di king kon giv di savant to polis mak dem sofa am wel-wel, ontil e pay evritin wey e dey hol.

35 “So, na laik dis my Papa for hevun go du una, if una nor forgiv una brodas from una heart."

Open Bible reader