Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Mark 7

1 Di Farisi pipol and som law tishas, wey kom from Jerusalem gada for wer Jisos dey.

2 Dem kon si sey Jisos disaipols dey chop bread wen dem neva wosh dia hand.

3 (Bikos di Farisi and Ju pipol, nor dey chop unles dem wosh dia hand akordin to dia tradishon.

4 And wen dem kom bak from market, dem nor dey chop unles dem first wosh dia hand. Dem stil dey folo meni oda tradishons, laik to wosh cup, ketol and chair wey dem dey sidan put chop.)

5 Di Farisi pipol and di law tishas kon ask Jisos, "Why yor disaipols nor dey du akordin to awa tradishon, bot insted dem dey chop wit dirti hand?"

6 Jisos ansa dem, "Di tin wey Isaia profesai abaut una, na tru, bikos una dey pritend, as dem rite for God wod, 'Dis pipol dey praiz Mi wit dia mout, bot dia heart dey far from Mi.

7 'Dem dey woship Mi for nor-tin, dey tish sey mak pipol obey humanbin law.

8 'Dem nor dey respet God law, bot dem dey obey humanbin law.'"

9 Jisos stil tel dem, "Una rejet God komandment, so dat una go fit kip una own.

10 "Bikos Mosis sey, 'Mak yu respet yor papa and mama' and 'Enibodi wey kos en papa or mama, dem must kil-am.'

11 "Bot if enibodi tel en papa and mama sey, 'Di moni wey I sopoz giv yu, I don giv God,'

12 so una nor go let di pesin du gud tin for en mama or papa.

13 "Na so una dey yuz una tradishon wey una dey tish pipol tak dey spoil God wod. And una stil dey du meni tins laik dis."

14 Den Jisos kol di pipol again sey, "Evribodi, listin to mi mak una for undastand wetin I dey tok.

15 "Nor bi wetin enta insaid pesin bodi go mak am dirti for God eye, insted na wetin kom out from en mout, dey mak am dirti.

16 "Enibodi wey get ear, mak e hear wetin I dey tok."

17 Wen Jisos liv di pipol enta haus, en disaipols kon ask am abaut di parabol.

18 E kon tel dem, "Na so una fool rish? Una nor no sey enitin wey from outsaid enta pesin bele nor go fit mak am dirti for God eye?

19 "Bikos nor bi di pesin heart e dey enta, na en bele and e go shit am komot. (Dis won min sey all fud dey klin.)"

20 Jisos kon sey, "Wetin kom out from insaid pesin, naim dey mak am dirti.

21 "Bikos to slip wit hu yu nor mari, to tif, to kil pesin,

22 to slip wit anoda pesin husban or wife, longtrot, evil tins, to disiv pesin, to dey misbihav, jelosi, to spoil anoda pesin, to kari bodi up and to du foolish tins, na from insaid pesin heart all dis bad-bad tins dey from kom.

23 "All dis evil tins dey kom from insaid pesin and na dem dey mak pesin dirti for God eye."

24 Afta Jisos komot from der, e kon go di aria wey dem dey kol Tyre. Wen e enta won haus, e nor wont mak enibodi no sey e dey der, bot e nor fit hide.

25 Won wuman wey evil spirit dey wori en dota kon hear abaut Jisos and e kom mit am kon fal for en front.

26 Di wuman na Greek wey kom from Fonicia for Syria. E kon beg Jisos mak e driv di dimon komot from en pikin bodi.

27 Bot Jisos tel am, "Mak di shildren chop beleful first, bikos e nor gud to tak shildren fud giv dog."

28 Di wuman ansa, "Yes, Oga, bot ivun dogs dey chop di smol-smol fud wey dey fal from shildren plate."

29 Jisos kon tel am, "Since yor fate strong rish to tok laik dis, mak yu dey go. Di dimon don komot from yor pikin bodi."

30 Wen di wuman rish haus, e kon si en pikin slip for bed and di dimon don liv am.

31 Den Jisos komot from Tyre kon pas Sidon go Galili Sea for Decapolis aria.

32 Som pipol kari won man wey nor dey hear or tok kom mit am sey mak e tosh di man wit en hand.

33 Wen Jisos don tak di man go kona for wer pipol nor dey, e kon put en tu fingas insaid di man ear, e spit for en hand kon tosh di man tongue.

34 Den e luk hevun kon sey, "Effata" (wey min, "Mak yu opun").

35 At wons, di man ear opun, en tongue luz and e kon start to tok.

36 Jisos kon sey mak dem nor tel enibodi wetin hapun. Bot dem kon dey tok am for evriwer.

37 Pipol sopraiz wel-wel dey sey, "Jisos don du evritin wel. E ivun mak di pipol wey nor dey hear, hear and pipol wey nor fit tok, e don mak dem dey tok."

Open Bible reader