Nigerian Pidgin Bible
Mark 5
1 So Jisos and en disaipols kon kros go di oda side for di riva for Gerasenes aria.
2 As Jisos jos dey kom dan from di boat, won man wey get evil spirit kon kom out from di beria groun, run kom mit am.
3 Na insaid beria groun di man dey stay and nobodi dey fit tie am, ivun wit chain.
4 Bikos dem don tie en hand and leg meni taims wit chain and handkoff, bot e kut dem trowey. Nobodi strong rish to hol am.
5 Evriday and nite for di beria groun near wer mountin dey, e dey shaut, dey yuz stone dey kut en bodi.
6 Wen e si Jisos dey kom from far, e run go mit am kon bow dan for en front.
7 Den e kon shaut, "Mak yu liv mi, Jisos, yu wey bi Almighti God Pikin! I tak God beg yu, nor sofa mi!"
8 (Bikos Jisos don tel di dimon bifor sey, "Komot from dat man bodi!")
9 Jisos ask am, "Wetin bi yor name?" E ansa, "My name na 'Legion,' bikos wi plenti."
10 E kon beg Jisos mak e nor driv dem komot from di aria.
11 For di mountin-side, plenti pig dey der dey chop.
12 So di dimon kon beg Jisos sey, "Oga, mak yu alow us enta di pig dem bodi."
13 So Jisos kon alow dem. So di evil spirit kom out from di man kon enta di pig dem. Den di pig dem run pas won low place enta di riva and dem rish tu tazon (2000) wey die insaid di wota.
14 So, di men wey dey gaid di pigs for der kon run go spread di news for di tawn and pipol for di aria kon go luk wetin hapun.
15 Wen dem kom mit Jisos, dem kon si di man wey dimon dey insaid am bifor sidan for der, e wear klot and en head koret, so fear kash dem.
16 Pipol wey si wetin hapun to di man wey get dimon bifor kon tel odas wey kom.
17 Den dem beg Jisos mak e komot for dia aria.
18 As Jisos dey enta boat, di man wey get dimon bifor kon ask weda e fit folo am.
19 Bot Jisos nor gri mak di man folo dem. Insted e tel am, "Go yor haus go mit yor pipol and mak yu tel dem wetin God don doh for yu, bikos God don sori for yu."
20 So di man kon go, bigin tok for di hol vilage abaut wetin God du for am and evribodi wey hear am, sopraiz wel-wel.
21 Wen Jisos don kros go di oda side wit boat, plenti pipol kon gada roun am for di wotasaid.
22 Den, won oga for di sinagog wey en name bi Jairus kon kom and wen e si Jisos, e fal for en front
23 dey beg am sey, "My smol dota don nearli die. Mak yu kom tosh am, so dat e go wel again."
24 Jisos and plenti pipol kon folo am and di pipol dey push Jisos from evri kona.
25 E get won wuman among dem wey don dey mestrate for twef years naw.
26 Dis wuman don sofa wel-wel for meni doktor hand and e don spend all di moni wey e get, bot insted of am to wel, di siknes kon dey wos more-more.
27 Wen e hear abaut Jisos, e waka go wer Jisos dey kon manage tosh en klot.
28 Bikos e tok for en maind sey, "If I go fit tosh en klot, I go wel."
29 At wons, di blood kon stop and e feel am for en bodi sey e don wel.
30 Na wons, Jisos no sey pawa komot for en bodi. E kon turn roun ask di pipol, "Hu tosh my klot?"
31 En disaipols kon ansa am, "Yu si all dis plenti pipol dey push yu and yu dey ask, 'Hu tosh mi?'"
32 Bot e kon dey luk evriwer mak e for si di pesin wey tosh am.
33 Fear kash di wuman wen e no wetin hapun to am, so e kom mit Jisos, nil dan for en front kon tel am evritin wey hapun.
34 So Jisos tel am, "My pikin, yor fate don mak yu wel. Mak peace folo yu and mak yu wel finish."
35 As Jisos stil dey tok, pipol from Jairus haus kon kom, tel am sey, "Yor dota don die. Why yu stil dey wori di Tisha?"
36 Jisos nor listin to dem, bot e kon tel di man, "Mak yu nor fear, bot mak yu jos biliv."
37 Jisos nor let enibodi folo am esept Pita, James and Jon, wey bi James broda.
38 Dem kon rish Jairus haus kon si plenti pipol dey mak nois, dey krai.
39 Wen Jisos enta, e tel dem, "Why una dey krai laik dis? Di pikin neva die, e jos dey slip."
40 Dem kon dey laff am. Jisos driv dem go outsaid, kon tak di pikin mama and papa wit di disaipols wey folo am, go insaid di room wer di pikin dead-bodi dey.
41 Den e hol di pikin hand smol-smol, kon tel am, "Talita kumi," wey min "Smol girl, get up."
42 Di girl (wey bi twef years dat taim) kon get up at wons bigin waka roun di haus. Evribodi sopraiz for wetin hapun.
43 Bot Jisos warm dem wel-wel sey, mak dem nor let enibodi no wetin hapun so, den e kon tel dem mak dem giv di pikin fud chop.