Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Mark 13

1 As Jisos dey komot from di Tempol varanda, won of en disaipol kon sey. "Tisha, si dis fain-fain stone wey dem tak build dis haus!"

2 Jisos kon ansa, "Una dey si all dis big haus? Dem nor go ivun liv won stone on-top anoda. All of dem go skata!"

3 As Jisos sidan for Mount Olives wey face di Tempol, Pita, James, Jon and Andru kom mit am wen odas nor dey and dem kon sey,

4 "Mak yu tel us wish taim dis tins go hapun and wetin go bi di sign to show sey di taim for dis tins to hapun, don rish?"

5 Jisos ansa dem, "Mak una tak kare, so dat nobodi go disiv una.

6 "Meni pipol go kom wit my name sey dem bi Jisos and dem go disiv meni pipol.

7 "Wen una hear abaut war wey dey hapun and rumor sey war won hapun, mak una nor fear. All dis tins must hapun, bot di end for di wold neva rish.

8 "Difren kontris and kindoms go fite ish oda. Eartquake and hunga go dey for meni place. Bot wen di wahala won start, e go bi laik wen wuman won born.

9 "Mak una shine una eye. Dem go tak una go kourt and dem go beat una for sinagog. Bikos of mi, una go stand for front of govnors and kings mak una for fit tel dem abaut mi.

10 "Bifor di wold go end, pipol must first prish di gospol for evri kontri for dis wold.

11 "Wen dem arres una kari go kourt, mak una nor wori abaut wetin una go tok. God go giv una wetin to tok for dat taim, bikos nor bi una go tok, bot na di Holi Spirit go du-am.

12 "Broda go betray en broda mak dem kil-am. Papa go sel en pikin giv dem tu. Shildren go betray dia papa and mama and dem go kil dem.

13 "Evribodi go hate una bikos of my name. Bot di pesin wey go fit bear rish end, go dey save."

14 "Wen una si wetin nor sopoz hapun dey hapun for di Holi Place (mak di pesin wey dey read, no wetin dis wod min), den doz wey dey Judea, must run go mountin.

15 "Mak di pesin wey dey on-top haus nor kom dan or go insaid en haus go kolet enitin.

16 "Mak di pesin wey dey farm nor go bak to en haus go kolet klot.

17 "For dat taim, e go bad wel-wel for wimen wey get bele and doz wit pikin wey stil dey suck breast!

18 "Mak una pray sey dis tins nor go hapun for di taim wen kold dey wel-wel.

19 "Bikos wen dis tins go dey hapun, di kaind sofa wey go dey, neva dey since wen God kreate dis wold and dat kaind sofa, nor go dey again.

20 "If God nor kut doz days short, nobodi go save. Bot bikos of di pipol wey God don shuz, E don mak doz days short.

21 "Dat taim, if enibodi tel una, 'Luk! Mak una si Jisos for here!' or 'Si-am for der!', mak una nor biliv dem.

22 "Bikos fake kraists and profets go kom and dem go du signs and mirakols wey bi laik majik to disiv pipol. If to sey e posibol, dem go disiv di pipol wey God don shuz.

23 "Mak una tak kare! I don tel una evritin bifor di taim go rish."

24 "Bot for dat taim, afta di sofa, di sun go dak and di moon nor go shine again.

25 "Di stars go fal from hevun and di pawa wey dey hol di skai, go shake.

26 "Den evribodi go si Man Pikin dey kom from insaid kloud wit strong pawa and glori.

27 "Den, God go send en angels go gada di pipol wey E don shuz from di for kona for di wold go rish hevun."

28 "Mak una learn wetin dis fig tri parabol min: Wen en bransh don dey soft and en leaf dey fal komot, mak una no sey dry season don near.

29 "So wen unasef si dis tins dey hapun, mak una no sey di taim wey Man Pikin go kom, don near.

30 "I tel una tru wod, di pipol for dis taim nor go die finish bifor all dis tins go hapun.

31 "Hevun and eart go vanish, bot my wod go dey foreva."

32 "Di day or di taim wen dis tins go hapun, nobodi no am, ivun angels for hevun nor no and God Pikin sef nor no tu. Na onli di Papa, for hevun no am.

33 "Mak una dey wosh and shine una eye, bikos una nor no wen di taim go rish.

34 "E go bi laik wen man dey travol go far. E liv en haus mak en savant luk am, giv dem wok to du kon tel di gateman mak e wosh en haus.

35 "So mak una shine una eye, bikos una nor no wen di haus owna go kom bak- weda na for evenin, nite, mornin or wen day don break.

36 "If not, e go fit kom bak wen una nor espet and e go mit una dey slip.

37 "Wetin I dey tel una so, I dey tel evribodi. So mak una shine una eye!"

Open Bible reader