Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Malachi 4

1 Almighty God talk say, “The day dey come when all proud and evil people go burn like straw. And on that day dem go burn up, and nothing go remain.

2 For una wey obey me, my saving power go dey on top una like sun and bring healing like sun rays. Una go dey free and happy like cow pikin wey dem allow commot for where dem keep am.

3 And on that day when I act, una go overcome the wicked, and dem go be like dust under una feet.

4 Make una remember the teaching of my servant Moses, the laws and commands wey I give am for Mount Sinai for people of Israel to dey obey.

5 I go send prophet Elijah to una before the great and terrible day of God come.

6 He go bring fathers and children together again; or else I go come and destroy una country completely.”

Open Bible reader