Nigerian Pidgin Bible
Luke 2
1 Dat taim, Caesar Augustus kon giv orda mak evribodi wey dey Rome go regista dia name mak dem for pay tax.
2 Dis na di first taim wey pipol go regista, since di tiam wen Kwirinus bi govnor for Syria.
3 Evribodi kon go en home-tawn go regista.
4 So Josef wey dey stay for Nazaret for Galili kon travol go Betlehem, David tawn for Judea, bikos na David famili e from kom.
5 Josef and Mary, wey e won mari and wey get bele, go regista togeda.
6 As dem dey for Betlehem, taim kon rish for Mary to born.
7 So e born en first son, wrap am kon put am for wer dem dey kip anima, bikos no oda place dey for dem to stay.
8 Som shepads dey for dat aria, dey kare for dia ship for nite.
9 God angel apier to dem and God glori kon dey shine for evriwer, den fear kon dey kash dem.
10 Di angel tel dem, "Mak una nor fear! Mak una listin wel, bikos I kom tel una news wey go mak pipol hapi.
11 "Today, dem born una Savior for dis tawn wey David from kom, en name na Kraist, wey bi di Oga.
12 "Na dis go bi sign wey una go tak no am: Una go si pikin wey dem yuz klot wrap insaid wer dem dey kip anima."
13 At wons, meni angels apier for hevun kon stand wit di first angel dey praiz God sey,
14 "Na onli God get Glori for hevun and eart, mak peace and favor dey wit evribodi."
15 Wen di angels go bak to hevun, di shepads kon tel ish oda, "Mak wi go Betlehem go si wetin hapun, wey God don show us so."
16 Dem kon go si Mary, Josef and di pikin for insaid di anima haus.
17 Wen dem si-am, dem kon tok haw di angel tak tel dem abaut di pikin.
18 Evribodi wey hear wetin dem tok, sopraiz wel-wel.
19 Bot Mary kip wetin e hear for en maind kon dey tink abaut am.
20 So di shepads kon go bak, dey praiz God, bikos of all di tins wey dem hear and si. Evritin jos bi as di angel tel dem sey e go bi.
21 Wen di pikin rish ate days, dem sekonsaiz am kon kol am, 'Jisos', di name wey di angel tok bifor en mama ivun get bele.
22 Wen taim rish for Mary to present ensef to God, as Mosis law tok, Josef and Mary kon kari Jisos go Jerusalem, go dedikate am giv God,
23 (as dem rite am for God wod, "Evri first born wey bi boy, dem go gi-am to Mi"),
24 and dem go offa sakrifais wit tu dove or pigin.
25 Won man dey Jerusalem wey en name bi Simeon and di Holi Spirit dey insaid am. Di man dey fear God and dey du wetin God laik and e dey wait for di taim wen God go fri Izrel.
26 Di Holi Spirit don show am sey e nor go die bifor e go si di Mezaya wey God promis.
27 So di Spirit kon tak Simeon enta di Tempol and wen Jisos papa and mama bring am to du wetin Mosis law tok,
28 Simeon kon kari Jisos for en hand dey praiz God sey,
29 "Naw, as yor wod tok, Yu, God wey dey rule evritin, mak Yu let yor savant go res.
30 "Bikos my eye don si di pesin wey Yu won mak e save Izrel pipol,
31 di Won wey Yu don priper for evribodi present:
32 "Na-im bi di lite wey go show Gentai pipol road kon bring onor to yor pipol, Izrel."
33 So di pikin papa and mama kon sopraiz for wetin Simeon tok abaut am.
34 Den Simeon bless dem kon tel Mary, "Listin wel-wel: God don shuz dis pikin to mak som pipol for Izrel fal and raiz odas up and e go bi sign wey meni pipol nor go asept.
35 "Tru-tru, bikos of am, di sikrit tins for meni pipol maind go kom out and vesnashon, laik sword, go shuk dia yor heart!"
36 Won profetess dey, wey en name bi Anna, Fanuel dota, wey kom from Asher famili. E don old wel-wel and e mari en husban for sevun years, bifor di man die.
37 E don rish eti-for years since en husban die. E nor dey komot for di Tempol, e dey serv God and dey fast and pray day and nite.
38 For dat taim, e kom mit Josef, Mary, di pikin and Simeon kon bigin tank God, dey tok abaut di pikin giv evribodi wey dey wait for di taim wen God go fri Jerusalem.
39 So, wen Josef and Mary don du all di tins wey God law sey mak dem du, dem kon go bak to dia haus for Nazaret for Galili.
40 Di pikin kon grow, dey strong, e get sense and God favor, dey wit am.
41 Evri year, Jisos papa and mama dey go Jerusalem for Passova Fist.
42 Wen Jisos bi twef years, dem kon go as dem dey du bifor
43 and as dem dey go bak to dia haus, Jisos nor folo dem, bot en mama and papa nor no;
44 bikos dem tink sey e dey wit dem wey dey travol togeda. Wen dem don travol for won ful day, dem kon dey faind Jisos among dia rilashons and frends.
45 As dem nor si-am, dem kon go bak to Jerusalem go faind am.
46 Afta tiri days, dem kon si-am insaid di Tempol, wer e sidan wit di tishas dey listin and dey ask dem meni kweshon.
47 Evribodi wey hear wetin Jisos dey tok kon dey sopraiz for di way e undastand and di ansa wey e dey giv.
48 Wen en mama and papa si-am, dem sopraiz wel-wel. Naim en mama sey, "My pikin, why yu du us laik dis? Si, mi and yor papa dey faind yu for evriwer since."
49 Jisos ansa dem, "Why una dey faind mi? Una nor no sey I go dey my Papa haus?"
50 Bot en mama and papa nor undastand wetin Jisos min.
51 Den Jisos folo dem go Nazaret kon dey du wetin dem tel am. Bot en mama kip all dis tins for maind.
52 Jisos kon get sense more-more as e dey grow, so God and pipol kon laik am wel-wel.