Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Luke 13

1 Som pipol wey dey der wen Jisos dey tok kon tel am haw Pilate kil som Galili pipol kon mix dia blood wit dia sakrifais.

2 Jisos ansa dem, "Una tink sey na doz Galili pipol sin pas evribodi, bikos dem sofa all dis tins?

3 "I tel una tru wod, nor bi so e bi! Unles una turn from sin kom mit God, all of una go die tu!

4 "Doz etin pipol wey die wen towa fal for dia head for Siloam, una tink sey na dia sin big pas for Jerusalem?

5 "I tel una tru wod, nor bi so e bi!? Unles una turn from sin kom mit God, all of una go die tu!"

6 Jisos tel dem dis parabol; "Won man plant fig tri for en farm, so e kon dey luk for frut from di tri, bot e nor si.

7 "Naim e kon tel doz wey dey wosh di farm sey, 'Since tiri years naw, I dey fine frut for dis tri, bot wen I luk, I nor dey si. So, mak una kut am dan! Why wi stil let am dey tak space?'

8 "Bot di farma ansa, 'Oga, stil liv am for dis year mak I put fertaliza,

9 "Den if e bear frut next year, wi go liv am, bot if e nor bear, yu fit kut am trowey.'"

10 Wen Jisos dey tish for won sinagog for Sabat Day,

11 won wuman wey evil spirit bend en bodi for etin years dey der.

12 Wen Jisos si-am, e kol di wuman kon tel am, "Wuman, yu don fri from yor trobol."

13 Jisos tosh di wuman and at wons, en bodi kon strate and e start to praiz God.

14 Bot di oga for di sinagog ves sey Jisos heal pesin for Sabat day, so e kon tel di pipol, "Wi get sis days wen pipol sopoz wok, so mak una kom mak dem heal una for doz sis days, bot nor bi for Sabat day."

15 Den Jisos ansa am, "Yu wey dey pritend! Una nor dey luz una melu or donkey from rope go drink wota for Sabat day?

16 So mak I nor fri dis wuman, wey bi Abraham pikin, wey dey Satan prizin for etin years, bikos today na Sabat?"

17 Wen Jisos tok dis tin, shame kon kash all en enimis, so di pipol kon dey hapi, bikos of wetin Jisos dey du.

18 Jisos ask di pipol, "Wetin God Kindom bi laik? Haw I won tak diskribe am?

19 "E bi laik mustard sid wey pesin plant for en farm. Di sid grow kon turn to big tri and birds build dia haus for di tri."

20 Jisos tok again sey, "Wetin I go tok sey God Kindom bi laik?

21 "E bi laik yist wey wuman mix wit tiri basket of flawa so dat di bread go raiz."

22 Jisos kon travol pas tawns and vilage dem dey tish as e dey go Jerusalem.

23 Sombodi kon ask am, "Oga, na onli few pipol God go save?" Jisos tel dem,

24 "Mak una strogol wel-wel so dat una go fit pas di smol door, bikos meni pipol go trai to enta God Kindom, bot dem nor go fit.

25 "If di Oga wey get di haus go lock di door, una go stand for outsaid dey nok and beg sey, "Oga, mak yu let us enta! Bot e go ansa, 'I nor no wer una from kom.'

26 "Den una go sey, 'Wi chop and drink wit yu and yu tish for awa tawns tu.'

27 "Bot e go sey, 'I nor no wer una from kom! Mak una nor near mi, una bi wiked pipol!'

28 "Una go krai dey grind tit wen una si Abraham, Izik, Jakop and all di profets insaid God Kindom, bot God go trow una for outsaid.

29 "Pipol go from east, west, nort and sout kon sidan for di parti for God Kindom.

30 "Den doz wey bi last, go bi first and doz wey bi first, go bi last."

31 Dat taim, som Farisi pipol kom mit Jisos tok sey, "Run komot for here, bikos Herod won kil yu."

32 Bot Jisos tel dem, "Mak una go mit dat yeye man tel am, 'Si, for today, tomoro and next tomoro, I go stil dey driv dimons dey heal pipol, ontil my wok go finish.

33 "Bot for today, tomoro and next tomoro, I go-go my way, bikos e nor fit hapun sey dem go kil profet outsaid Jerusalam.

34 Jerusalem pipol! Jerusalem pipol! Una wey kil profets and stone pipol wey God send kom mit una! E don tey wey I won gada una shildren as fawo dey gada en pikin unda en feda, bot una nor gri!

35 "Mak una luk, una shildren don skata! And I tel una tru wod, una nor go si mi again ontil una go sey, 'God don bless di pesin wey kom wit en name!'"

Open Bible reader