Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

John 2

1 Wen tiri days don pas, Mary, wey bi Jisos mama, go won marage for Kana, wey dey for Galili.

2 Dem invait Jisos and en disaipol for di marage tu.

3 Wen wine finish, Jisos mama kon tel am, "Dia wine don finish."

4 Jisos ansa am, "Mama, why yu dey tel mi dis? My taim neva rish."

5 So en mama kon tel di savants sey, "Enitin wey e tel una, mak una du-am."

6 For dat place, sis big wota pot dey and ish won fit kontain abaut twenti to tati gallon for wota, wey di Ju pipol dey yuz wosh leg as dia tradishon tok.

7 Jisos kon tel di savants, "Mak una ful di pots wit wota." So dem kon ful all di pot wit wota.

8 Jisos tel dem, "Mak una tak som wota from di pot go giv di chairman for di parti." So, dem kon du as e tok.

9 Wen di chairman taste di wota wey don turn to wine, bikos e nor no haw e hapun (bot di savants wey draw di wota no), e kon kol di man wey dey mari tel am sey,

10 "Wen pesin dey du parti, na beta wine e dey first serv pipol, den wen di pipol don drink taya, naim e dey serv cheap wine. Bot yu kon kip di gud wine ontil di parti don won finish."

11 Dis na di first mirakol wey Jisos du and e hapun for Kana wey dey Galili. Dis na haw e show en onor, so en disaipols kon biliv am.

12 Den Jisos wit en mama, brodas and en disaipols kon go Kapanum. Dem kon stay der for som days.

13 By dis taim, di Ju Passova Fist don near wel-wel, so Jisos kon go Jerusalem.

14 E si di pipol dey sel melu, ship and dove insaid di Tempol yard, e stil si pipol wey dey shange moni, sidan near dia tabol.

15 E yuz koboko wey e mak, tak driv dem wit dia ship and melu komot from di Tempol yard. E trowey di tabol wey di pipol dey tak shange moni and dia moni kon skata.

16 E kon tel di pipol wey dey sel dove, "Mak una kari all dis tins komot for here. Mak una nor turn my Papa haus to market."

17 Den en disaipols kon rimemba as den rite for Psalm Book sey, "Di luv wey e get for en Papa haus dey burn for en heart laik fire."

18 Di Ju oga dem kon ask am, "As yu dey du all dis tins, na wish sign yu go show us mak wi for fit biliv yu?"

19 Jisos ansa dem, "Ivun if una distroi dis Tempol, for tiri days taim, I go build am again."

20 Den di Ju oga dem tel am, "Na forti-sis years dem tak build dis Tempol and yu dey sey yu go fit build am for tiri days?"

21 Bot na di Tempol for Jisos bodi naim e dey tok abaut.

22 So wen Jisos don wak-up from deat, en disaipols kon rimemba sey, e tok so bifor. Den dem kon biliv wetin dem rite for God wod and wetin Jisos tel dem.

23 Jisos dey for Jerusalem by di taim wey dem dey du di Passova Fist. For der, meni pipol kon biliv am, bikos dem si di mirakols wey e du.

24 Bot Jisos nor gri opun en maind giv di pipol, bikos e no dem wel-wel.

25 E nor nid enibodi to tok abaut am, bikos e no wetin dey insaid pipol bele, so e nor fit trust dem.

Open Bible reader