Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

John 17

1 Wen Jisos don tok all dis tins finish, e luk up go hevun kon sey, "My Papa, di taim don kom wen Yu go giv glori to yor pikin, so dat yor pikin go giv Yu glori tu.

2 "Jos as Yu don giv mi pawa ova all di pipol for di wold, na so tu I go giv life wey nor dey end to evribodi wey Yu giv mi.

3 "Life wey nor dey end, dis na wetin e min, 'Na mak pipol no yu wey bi di onli tru God and Jisos Kraist, wey Yu send.'

4 "I don giv Yu glori for dis wold and I don finish di wok wey Yu send mi.

5 "And naw, Papa onor mi, mak Yu draw mi near Yu, jos as wi dey bifor di wold start."

6 "I don mak di pipol wey Yu giv mi for dis wold no yor name. Na yor own dem bi bifor Yu giv dem to mi and dem don obey yor wod.

7 "Naw, dem don no sey evritin wey Yu giv mi kom from Yu,

8 bikos I don tel dem di mesage wey Yu giv mi. Dem don asept wetin I tel dem and dem no and biliv sey na Yu send mi.

9 "I dey pray for di pipol wey Yu giv mi, bikos dem bi yor own, bot I nor dey pray for di oda pipol wey dey insaid di wold.

10 "Evritin wey I get, na yor own and evritin wey Yu get, na my own and dem don onor mi.

11 "I nor go dey di wold again, bot dem go stil dey insaid di wold, since I won kom mit Yu. Holi Papa, mak yor name protet di pipol wey Yu giv mi, so dat dem go bi won, jos as mi and Yu na won.

12 "Wen I dey wit dem, I kip dem wit yor name. No won loss, esept di won wey yor wod sey e go perish.

13 "Since I dey kom mit Yu, I dey tok all dis tins for di wold, so dat dia joy go ful wel-wel.

14 "I don giv dem yor wod and bikos of dat, di pipol for wold hate dem, since dem nor bilong to di wold, as misef nor bilong to di wold.

15 "I nor sey mak Yu rimov dem from di wold, bot mak Yu protet dem from di devol.

16 "Dem nor bilong to di wold, jos as misef nor bilong to di wold.

17 "Mak Yu protet dem wit di trut, bikos na yor wod bi di trut.

18 "Jos as Yu send mi kom insaid dis wold, na so tu I send dem go insaid di wold.

19 "I don seprate mysef from di wold for dia sake, so dat dem go fit seprate diasef from di wold tu."

20 "I nor dey pray for dem alone, bot I also dey pray for oda pipol wey go biliv mi tru di wod wey dem go tok abaut mi.

21 "Papa, I dey pray, so dat all of dem go get won maind, jos as mi and Yu bi won. I stil dey pray mak dem dey wit us, so dat di wold go biliv sey na Yu send mi.

22 "I don giv dem di onor wey Yu giv mi, so dat dem go bi won jos as wi bi won:

23 "I dey wit dem and Yu dey wit mi, so dat dem go rili bi won, jos as wi bi won and di wold go no sey na Yu send mi and Yu luv dem, as Yu luv mi.

24 "Papa, I wont mak di pipol wey Yu giv mi stay wit mi for wer I dey, so dat dem go si di glori wey Yu giv mi, bikos Yu luv mi bifor Yu mak di wold.

25 "Holi Papa, ivun if di pipol for di wold nor no Yu, I no Yu and dis wons no sey na Yu send mi.

26 "I don help dem no yor name and I go dey trai to mak oda pipol no am tu, so dat di luv wey Yu get for mi, go dey wit dem, as I dey wit dem.

Open Bible reader