Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

John 12

1 Sis days bifor Passova Fist rish, Jisos go Betani, wer Lazarus, di pesin wey e wak-up from deat, dey stay.

2 So dem kon du parti for Jisos dat evenin. Marta kon dey serv dem fud and Lazarus dey among di pipol wey sidan for tabol wit Jisos.

3 Mary tak perfume wey dear wel-wel, wey plenti rish quota galon kon pour am for Jisos tu leg. Den e yuz en hair tak klin dem. (Di perfume sent kon ful evriwer for insaid di haus).

4 Bot Judas Iskarot, won of Jisos disaipol (di pesin wey go sel am giv en enemis), kon sey,

5 "Why wi nor sel dis perfume for tiri ondred koins (moni wey pas wetin wokas go get for won year) kon giv di moni to poor pipol?"

6 (Judas tok laik dis, nor bi sey e kare for poor pipol, bot bikos na tif e bi. As e bi sey naim dey kip di moni, e dey tif from am.)

7 Den Jisos ansa, "Mak yu nor trobol di wuman, e du dis tin dey wait di day wen dem go bere mi.

8 "Poor pipol go always dey wit una, bot I nor go dey wit una all di taim."

9 For dis taim, plenti pipol wey dey Judea hear sey Jisos dey for dia tawn, so dem kon gada, nor bi bikos of Jisos alone, bot dem won si Lazarus tu, di pesin wey die bifor, wey Jisos wak-up.

10 Di prist oga dem kon plan to kil Lazarus tu,

11 bikos naim mak plenti Ju pipol for Jerusalem, biliv Jisos.

12 Wen day break, plenti pipol wey kom di Fist kon hear sey Jisos dey kom Jerusalem.

13 Di pipol tak palm tri leaf go wait am for road. Dem kon bigin shaut, "Hosanna, mak God bless di pesin wey E send kom mit us. Mak God bless Izrel king!"

14 Jisos si won smol donkey and e kon sidan put, jos as God wod sey,

15 "Pipol wey dey Zion, mak una nor fear; mak una si una king sidan on-top donkey dey kom!"

16 (En disaipols nor undastand dis tins wey dey hapun, ontil wen Jisos don wak-up from grave, naim dem kon rimemba wetin God wod sey go hapun.)

17 So di pipol wey dey wit am wen e wak Lazarus from grave kon tel odas abaut am.

18 And dem gada go mit Jisos, bikos dem hear sey na-im wak Lazarus from grave.

19 Den di Farisi pipol kon tel ish oda, "Una dey si sey wetin wi dey du so nor get head! Si o-o, evribodi don bigin folo am."

20 Som Greek pipol go woship God for di fist for Jerusalem.

21 Dem kon mit Filip wey kom from Betsaida for Galili kon tel am, "Oga, wi go laik to si Jisos."

22 Filip tel Andru, den dem kon go tel Jisos.

23 Jisos tel dem, "Di taim don kom wen God go onor en own pikin.

24 "I tel una tru wod, if won corn sid fal for groun and e nor die, e nor go grow, bot if e die, e go grow kon bear plenti sid.

25 "Enibodi wey luv en life for dis wold, go luz am, bot di pesin wey nor luv en life for dis wold, go get life wey nor dey end.

26 "Enibodi wey redi to serv mi, go must folo mi and wer I dey, na der my savant go dey tu. Enibodi wey serv mi, my Papa go onor am.

27 "My heart heavi wel-wel. Wetin I go tok? 'Papa, mak yu save mi from dis tin wey won hapun'? No! Na dis tin mak mi kom dis wold.

28 "Papa, mak yu onor yor name." Den won vois tok from hevun sey, "I don onor am bifor and I go onor am again."

29 Wen di pipol wey dey di place hear di vois, som kon sey, "Di vois sound laik thunda", bot odas sey, "Na angel dey tok to am."

30 Jisos kon sey, "Dis vois nor tok bikos of mi, bot na bikos of una."

31 Di taim to joj di pipol for dis wold don rish and God go driv Satan, wey dey kontrol dis wold komot.

32 Bot as for mi, if una kari mi go up for kros, I go draw evribodi kom mit mi."

33 (E tok laik dis, mak pipol for no di way e go tak die).

34 Den di pipol ask, "Wi no sey God law sey, 'Kraist go liv foreva.' Why yu kon dey tok sey dem go kari Man Pikin put for kros? Na hu bi dis Man Pikin sef?"

35 Jisos ansa dem, "My lite nor go dey wit una tey. Naw wen di lite dey, mak una tak am waka, so dat daknes nor go kova una. Bikos di pesin wey dey waka for daknes, nor dey si wer e dey go.

36 "As una get di lite naw, mak una biliv am, so dat una go bi lite shildren. Wen Jisos don tok dis tin finish, e kon komot der go hide.

37 Aldoh Jisos don du meni mirakol for dia front, dem nor stil biliv am.

38 Dis mak wetin Profet Isaia tok hapun, wen e sey, "Oga, wish pipol don biliv wetin wi tok and hu God don show en pawa?"

39 As di pipol nor fit biliv, naim mak Isaia tok anoda wod sey,

40 "God don blind dia eye and mak dia heart strong laik stone, so dat dem nor go si wit dia eye and undastand wit dia heart, so dem nor go fit kom mit mi, mak I for heal dem."

41 Isaia tok dis tins, bikos e si haw God onor and tok abaut Kraist.

42 Meni pipol and meni Ju oga kon biliv Jisos, bot bikos of di Farisi pipol, doz wey biliv nor fit tok for publik abaut Jisos Kraist, so dat dem nor go driv dem komot for di sinagog.

43 Bikos Ju pipol laik mak pipol dey praiz dem pas wetin God tink abaut dem.

44 Jisos kon shaut sey, "Di pesin wey biliv mi, nor bi mi e biliv, bot na my Papa wey send mi.

45 "And di pesin wey si mi, don si God wey send mi.

46 "I kom as lite for dis wold, so dat enibodi wey go biliv mi nor go waka insaid daknes.

47 "Enibodi wey hear wetin I tok and nor obey am, nor bi mi go joj am, bikos I nor kom joj di wold, bot I kom save pipol for di wold.

48 "Enibodi wey rejet mi and nor du wetin I tok, God go yuz dis my wod joj am for di last day.

49 "Bikos nor bi my pawa I tak dey tok, bot na my Papa wey send mi dey tel mi wetin I dey tok.

50 "I no sey enitin wey God komand, dey giv life wey nor dey end, so I dey tok wetin E send mi."

Open Bible reader