Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

John 10

1 "Na tru wod I dey tel una, pesin wey nor pas door enta di place wey dem dey kip ship, bot klimb pas anoda side enta di place, na big tif.

2 "Di pesin wey pas di door enta, na-im bi di shepad wey dey gaid di ship.

3 "Di gateman go opun di door for am and en ship go hear en vois wen e kol dia name and e go lid dem kom out.

4 "Wen e don bring all en ship kom out, e go-go dia front and di ship go folo am, bikos dem no en vois.

5 "Dem nor go gri folo stranja, bot dem go run from am, bikos dem nor no di stranja vois."

6 Jisos tel dem dis parabol, bot dem nor undastand wetin e tok.

7 So Jisos kon tel dem again, "I dey tel una tru wod. Na mi bi di door wey di ship go must pas enta.

8 "All di pipol wey kom bifor mi, na big tif dem bi and di ship nor go gri listin to dem.

9 "Na mi bi di door, enibodi wey enta tru mi, God go save am. E go-go insaid and out and e go si beta grass chop.

10 "Di tin wey tif dey du, na to tif, kil and distroi pipol, bot mi, I kom so dat pipol go get life, di kaind life wey ful wel-wel.

11 "Na mi bi di gud shepad. Di gud shepad redi to die for di ship.

12 "Di pesin wey dem haya nor bi di shepad and bikos nor bi en get di ship, e go run wen e si lion dey kom, so di lion go skata di ship, kon kil di won wey e kash.

13 "Bikos di pesin nor kare for di ship, naim go mak am run liv dem.

14 "Na mi bi di gud shepad, I no di ship wey bi my own and dem no mi tu.

15 bikos my Papa no mi and I no am, naim mak mi redi to die for di ship.

16 "I get oda ship wey nor dey here. I must gada dem tu and dem go listin to my vois, all of dem go dey togeda and na won shepad go lid dem.

17 "Na dis bi di rizin wey mak my Papa laik mi, bikos I redi to sakrifais my life, so dat I go fit tak am bak again.

18 "Nobodi go fit tak my life from mi, bot na mi go put am dan by mysef and I get di pawa to tak am bak again. Dis na wetin God komand mi to du."

19 Anoda big kworel kon hapun bitwin di Ju pipol bikos of wetin Jisos tok.

20 Meni of dem kon dey sey, "Dimon dey insaid am and en head nor koret. Why una dey listin to am sef?"

21 Odas kon sey, "Di pesin wey get dimon nor go fit tok laik dis. No dimon fit mak blind pesin si."

22 Di taim for di Dedikeshon Fist for Jerusalem kon rish.

23 Dat na di taim wey rain dey fal (and kold dey strong wel-wel) and Jisos kon dey waka insaid di varanda wer Solomon for dey tak briz, wey dey insaid di Tempol yard.

24 Di Ju oga dem gada roun Jisos, kon ask am, "Haw long yu go mak us dey wait? If na yu bi di Kraist, mak yu tel us."

25 Jisos ansa dem, "I don tel una and una nor biliv. Di tin wey I tak my Papa name dey du, dey bear witnes for mi.

26 "Bot una nor biliv mi bikos una nor bi my ship.

27 "My ship dey hear my vois and I no dem and dem dey folo mi.

28 "I don giv dem life wey nor dey end and dem nor go eva die. Nobodi go fit tak dem komot from my hand.

29 "My Papa wey giv dem to mi big pas evribodi and nobodi go fit tak dem komot from my Papa hand,

30 bikos mi and my Papa, na won."

31 Di Ju oga dem kon pick stone again, to tak stone am.

32 So Jisos tel dem, "I don du meni gud tins wey una si from my Papa, wish won mak una won stone mi so?"

33 Di Ju oga dem kon ansa, "Wi nor won stone yu bikos of di gud tins, bot na bikos yu wey bi ordinari pesin, dey mak mout sey, yu bi God."

34 Jisos kon ansa dem, "Una law nor tok sey, I sey, 'Una bi gods?'

35 "If dem kol di pipol wey God send en wod go mit, sey, 'Dem bi gods' and God wod nor go eva shange,

36 'Why una dey tel di pesin wey God shuz for ensef and wey E send kom dis wold, "Yu dey tok against God", bikos I sey, "I bi God Pikin?'"

37 "If I nor du di tins wey my Papa send mi, mak una nor biliv mi.

38 "Bot if I dey du dem, ivun if una nor biliv mi, mak una biliv di tins wey I dey du, so dat una go no and undastand sey, I dey insaid my Papa and my Papa dey insaid mi tu."

39 So dem trai again to kash am, bot e kon waka liv dem.

40 Jisos go bak kon kros Jordan Riva, wer Jon for baptize pipol and e kon stay for der.

41 Meni pipol kon mit Jisos for di place. Dem bigin dey sey, "Ivun doh Jon nor du eni mirakol, bot evritin wey e tok abaut Jisos, na tru."

42 And meni pipol for di place kon biliv Jisos.

Open Bible reader