Nigerian Pidgin Bible
Job 28
1 E get land wey dem dey dig silver; e get place where dem dey purify gold.
2 People dey dig iron commot from ground and melt copper commot from the stone
3 Dem dey search the darkness wey deep pass. Dem dey search depth of earth and dig rock for darkness.
4 Far from where anybody dey live or where human leg don ever travel, dem dig pit. Dem dey alone when dem dey work, and dey use rope hang inside pit.
5 Food dey grow out on top earth, but wetin dey under am dey different, e be like say fire don melt everything.
6 Na sapphire and dust of pure gold dey there.
7 No hawk dey see the road to where the treasure dey. And no vulture dey ever fly on top them.
8 No lion or other terrible animal don ever travel that road.
9 Digger dey dig the rock wey hard pass, dem dey dig mountain and make way for their bottom.
10 As dem dig through the rock, dem dey see precious stone.
11 Dem dig reach where river water dey come from and bring light to wetin dey hide.
12 But where we fit find wisdom? Where we fit learn how to understand?
13 Dem no suppose see wisdom among human being; nobody know the true value of am.
14 Ocean depth and sea talk say dem no fit find wisdom there.
15 Nobody fit buy wisdom with silver or gold.
16 The gold wey fine pass and jewel no fit dey equal to the value.
17 E get value pass gold, pass jewel wey dem use gold decorate or glass wey fine pass.
18 Wisdom get value pass coral or crystal or rubies.
19 Topaz wey fine pass and gold wey pure pass no fit compare with the value of wisdom.
20 Where con be the source of wisdom? Where we fit learn to dey understand?
21 No living creature fit see am, no be even bird wey dey fly.
22 Even death and destruction gree say na only rumor dem hear.
23 Na only God know the way, and the place where wisdom dey,
24 Because he dey see the end of the earth, and he dey see everything wey dey under the sky.
25 When God give wind power and decide the size of sea;
26 When God decide where rain go fall, and the way wey the thundercloud go travel;
27 Na that time him see wisdom and test the value - he con give am approval.
28 God tell human being say, For una to dey wise, una must show respect for the LORD. For una to understand, una must turn from evil.