Nigerian Pidgin Bible
Jeremiah 52
1 Zedekiah na 21 years old when he become king of Judah, and he rule in Jerusalem for eleven years. Him mother name na Hamutal, daughter of Jeremiah wey dey live for the city of Libnah.
2 King Zedekiah sin against God, just as king Jehoiakim don do.
3 God con vex with the people of Jerusalem and Judah so tey he chase them commot from him presence. Zedekaih don rebel against king Nebuchanezzar of Babylonia,
4 Naso Nebuchadnezzar come with all him army and attack Jerusalem on the tenth day of the tenth month of the ninth year wey Zedekiah be king. Dem set up camp outside the city, dem build boundary walls round am,
5 And dem keep am under seige until eleventh year of Zedekiah.
6 On the ninth day of the fourth month of the same year, when hunger dey bad so tey people no get anything to eat again,
7 Dem break through the city wall. Although Babylonians dey surround the city, all the soldiers escape for night. Dem follow the royal garden way commot, dem commot through the gate wey dey connect the two walls, and dem run away in the direction of the Jordan Valley.
8 But army of Babylonia pursue king Zedekiah, and capture him for lowland near Jericho, and all him soldier leave him.
9 Dem take Zedekiah go meet king Nebuchadnezzar, wey dey the city of Riblah for the territory of Hamath, and Nebuchadnezzar pass sentence on top him for there.
10 For Riblah he kill Zedekiah son as Zedekiah dey watch and also kill the officials of Judah.
11 After that, he remove Zedekiah eyes and chain him and take him go Babylonia. Zedekiah remain for prison until the day wey he die.
12 On the tenth day of the fifth month of the nineteenth year of king Nebuchadnezzar of Babylonia, Nebuzaradan, wey be adviser to the king and commander of him army, enter Jerusalem.
13 He burn down the Temple, the palace, and house of all important people in Jerusalem,
14 And him soldier tear down the city walls.
15 Then Nebuzaradan take away the people wey remain for the city go Babylonia, the skilled men wey remain, and those wey don run go meet Babylonians before.
16 But he leave some of the people wey poor pass for Judah, wey no get any property, and he say make dem dey work inside vineyards and fields.
17 The Babylonians break the bronze pillar into pieces and the wagon wey dey inside temple, together with the large bronze tank, and dem take all the bronze go Babylon.
18 Dem also take away the shovel and ash container wey dem dey use clean the altar, the tools wey dem dey use hang the lamp, the bowls wey dem dey use for catching the blood from sacrifice, the bowls wey dem dey use burn incense, and all other bronze things wey dem dey use inside Temple.
19 Dem take away everything wey dem make with gold or silver: the small bowl, the pan wey dem dey use carry live coal, the bowl wey dem dey use hold the blood from the sacrifice, the ash container, the lampstand, the bowl wey dem dey use for incense, and the bowls wey dem dey use pour out wine offering.
20 The bronze object wey King Solomon don make for the Temple- the two pillars, the wagon, the large tank, and the twelve bull wey support am- dey too heavy to weigh.
21 The two pillars look alike: each one na 8 meters high and 5.3 meters round. Dem get hole inside, and the metal na 75millimeters thick.
22 Thick bronze wey be 2.2 meters high dey on top each pillar, and dem use pomegranate take decorate round hin edges, na bronze dem use make all of them.
23 Na 100 pomegranates dey for edges of each pillar, and 96 of these dey visible from the ground.
24 In addition, Nebuzaaradan, the commanding officer, take away Seraiah the High Priest, Zephaniah the priest wey dey next in rank, and the three other important temple officer as prisoner.
25 He con take from the city the official wey don dey in command of the army, seven of the king personal adviser wey still dey the city, the commander assistant, wey dey in charge of military record, and sixty other important men.
26 Nebuzaradan con take them go meet the king of Babylonia, wey dey the city of Riblah
27 in the territory of Hamath. The king say make dem beat them and kill them. Naso dem carry the people of Judah away from their land go foreign land.
28 Na the record of the people wey Nebuchadnezzar take away as prisoner be this: He take away 3,023 for the seventh year wey he be king;
29 He take away 832 from Jerusalem for him eightheenth year;
30 And for him 23rd year he take away 745. In all, na 4,600 people he take away.
31 In the year wey Evilmerodach become king of Babylonia, he dey nice to King Jehoiachin of Judah and he release him from prison. This thing happen on the 25th day of the twelfth month of the 37th year after dem don take away Jehoiachin as prisioner.
32 Evilmerodach treat him well and give him position of honour wey great pass the one wey he give other kings wey be foreigners with him in Babylonia.
33 So dem allow Jehoiachin make he change from him prison clothes and make he chop at the king table for rest of him life.
34 Each day, dem dey give him regular allowance for anything wey he need as long as he dey alive.