Nigerian Pidgin Bible
Jeremiah 51
1 God talk say, I dey bring wind wey dey destroy against Babylonia and hin people.
2 I go send foreigners make dem destroy Babylonia like wind wey blow chaff commot. When that day of destruction come, dem go attack from all side and dem go empty the land.
3 Make una no give their soldier chance to shoot their arrow or wear their protection. Make una no leave their young men alive! Make una destroy all the army!
4 Dem go wound and die for street of their cities.
5 I, the LORD God Alimghty, I never abandon Israel and Judah , even though dem don sin against me, the Holy one of Israel.
6 Make una run away from Babylonia! Make una run for una lives! Make una no die because of Babylonia sin. I dey take my revenge now and I dey punish am as I suppose punish am.
7 Babylonia be like gold cup for my hand before, wey dey make all the world drunk. The nations drink hin wine and dem loose thier mind.
8 Babylonia don fall suddenly and e don destroy! Make una mourn over am! Make una get medicine for hin wound, and maybe e fit heal.
9 Foreigners wey dey live for there talk say, We try make we help Babylonia, but e don late. Make we leave her now and go back home. God don punish Babylonia with all him power and he don destroy am completely.
10 God talk say, My people, shout, The Lord don show say we dey righteous. Make we go tell people of Jerusalem wetin the LORD our God don do.
11 God don wake up kings of Media, because he wan destroy Babylonia. Naso he go take revenge of the destruction of him Temple. The attacking officers command say, Make una sharpen una arrow! Make una get una protection ready!
12 Make na give signal to attack walls of Babylon. Make una strengthen the guard! Make una post the guard! Put men to set trap! God don do wetin he talk say he go do to people of Babylonia.
13 That city get plenty rivers and rich treasures, but hin time don finish, and him life don finish.
14 God don swear with him own life say he go bring plenty men to attack Babylonia like plenty locust, and dem go shout with victory.
15 God use him power make the earth; he use him wisdom take create the world and stretch out the heavens.
16 The water wey dey above the sky dey shout when him command; he dey bring cloud from the ends of the earth. He dey make lightning flash inside rain and he dey send wind from him storeroom.
17 As people dey see this, people dey feel stupid and senseless; those wey make idols con dey discouraged because the god wey dem make na false god wey no get life.
18 Dem no get value and people suppose hate them; dem go perish when God come deal with them.
19 The God of Jacob no be like them; na him be the one wey make everything, and he don choose Israel to be him own people. Him name na the LORD Almighty.
20 God talk say, Babylonia, una be my hammer, my weapon of war. I use una destroy nations and kingdoms,
21 To destroy horses and riders, to destroy chariots and their drivers,
22 To kill men and women, to kill old and young, to kill boys and girls,
23 To kill shepherds and their flocks, to kill farmers and their horses, to destroy rulers and high officials.
24 God talk say, Una go see say I go pay back Babylonia and hin people for all the evil wey dem do to Jerusalem.
25 Babylonia, una be like mountain wey destroy all the world, but I, the LORD, I be una enemy. I go capture una, level una go ground, and leave una in ashes.
26 Nobody go use any of the stones wey remain from una destruction for building again. Una go be like desert for ever. I, the LORD, don talk.
27 Make una give the signal to attack! Blow the trumpet so that the nations fit hear! Make una prepare the nations for war against Babylonia! Tell kingdom of Ararat, Minni, and Ashkenaz make dem attack. Appoint officers make dem lead the attack. Make una bring up horses make dem plenty like locust.
28 Make una prepare the nation for war against Babylonia. Make una send for the kings of Media, their leaders and officials, and army of all country wey dem dey control.
29 The earth dey vibrate and shake because God dey do wetin he don plan say he go do to turn Babylonia to desert, where nobody dey live.
30 The Babylonian soldier don stop to dey fight and dem don remain for their strong wall. Dem don lose their courage and dem don dey act like woman. The city gate don break down, and fire don catch the houses.
31 Messenger after messenger dey run go tell king of Babylonia say him city don break from every side.
32 The enemy don capture the river crossing and dem don set the strong wall on fire. Fear don catch Babylonian soldiers.
33 Soon the enemy go cut them down and go match them like say dem dey match corn. I, the LORD Almighty, the God of Israel, don talk.
34 The king of Babylonia cut Jerusalem up and chop am. He empty the city like say na bottle, He swallow am like say him be monster. He take everything wey he want and throway the remaining.
35 Make the people of Zion say, Babylon don do terrible things to hurt us. Now, we wan make those things happen to Babylon. Make city of Jerusalem talk say, People of Babylon dey guilty of killing our people. Now dem dey receive punishment for the bad things wey dem don do.
36 Naso God tell people of Jerusalem say, I go take up una case and I go make una enemy pay for wetin dem don do to una. I go dry up source of Babylonia water and I go make their river dry.
37 That country go turn to where wild animal dey live. E go be a terrible sight; no one go live for there, and all people wey see am go fear.
38 All the Babylonians dey shout like lion and dem dey make noise like lion pikin.
39 Shey na hunger dey wire them? I go prepare feast for them and I go make them drunk and happy. Dem go sleep and dem no go wake up again.
40 I go kill them, like lamb, goat, ram. I, the LORD, don talk.
41 God talk about Babylonia say: Enemy don capture the city wey all the world dey praise! Babylonia don become where nations dey fear to see!
42 The sea don roll over Babylon and cover am with noise of waves.
43 The towns don become horrible sight and e be like desert wey no get water, where no one dey live or follow travel.
44 I go punish Bel, the god of Babylonia, and I go make him release all the goods wey he don steal; the nations no go worship him again. Babylonia wall don fall.
45 People of Israel, make una run away from there! Make una run for una life from my terrible anger.
46 Make una no loose courage or fear because of the rumour wey una don hear. Na every year different rumour dey spread- rumours say violence dey the land and say one king dey fight another.
47 So the time dey come when I go deal with Babylonia idols. Shame go catch the whole country, and all hin people go die.
48 Everything on earth and for sky go shout for joy when Babylonia fall to the people wey come destroy am from the north.
49 Na Babylonia cause the death of people all over the world, and now Babylonia go fall because e don cause the death of plenty Israelites. I, the LORD, don talk.
50 God tell him people for Babylonia say: Una don escape death! Now go! Make una no wait! Though una dey far from home, make una think about me, una LORD, and make una remember Jerusalem.
51 Una talk say, Shame don catch us; we feel say we dey helpless because foreigners don take over the holy place inside Temple.
52 So then, I talk say the time dey come when I go deal with the Babylonia idols, and people wey don get wound go cry all over the country.
53 Even if Babylonia fit climb go sky and build strong wall for there, I go send people make dem destroy am. I, the LORD, don talk.
54 God talk say, Make una hear the sound of cry for Babylonia, and sound of mourning of destruction in the land.
55 I dey destroy Babylon and I dey silence am. The armies rush go inside like noise of waves and dem dey attack with shout of noise.
56 Dem don come to destroy Babylon; dem don capture hin soldier, and their bows don break. I be God wey dey punish evil, and I go treat Babylonia as dem deserve.
57 I go make hin ruler drunk - men of wisdom, leaders, and soldiers. Dem go sleep and dem no go wake up again. I, the King, don talk, I be the LORD Almighty.
58 The walls of mighty Babylon go fall for ground and hin gate go catch fire. The work of the nations na for nothing, their effort don catch fire. I, the LORD, don talk
59 King Zedekiah personal assistant na Seraiah, son of Neriah and grandson of Mahseiah. In the fourth year wey Zedekiah be king of Judah, Seraiah dey go Babylonia with him, and I give am some instruction.
60 I write the account of all the destruction wey go come on Babylonia for book, and even all these other things.
61 I tell Seraiah say, When una get to Babylon, make you dey sure say you read everything wey dey inside this book loud to the people.
62 Then you pray say, LORD, you don talk say you go destroy this place, so that living creature no go dey inside am, be it people or animals, and e go be like desert for ever.
63 Seraiah, when you finish to dey read this book to the people, then tie am to stone and throw am inside Euphrates River,
64 And talk say, Na wetin go happen to Babylonia be this - e go sink and e no go rise again, because of the destruction wey God go bring on top am Na here the words of Jeremiah end.