Nigerian Pidgin Bible
Jeremiah 46
1 God follow me talk about the nations,
2 starting with Egypt. Na wetin he talk about army of king Neco of Egypt, wey king Nebuchadnezzar defeat for Carchemish near River Euphrates in the fourth year wey Jehoiakim be king of Judah be this:
3 The Egyptian officers shout say, Make una get una shield ready and march go battle!
4 Make una control una horses and mount them! Make una fall in line and wear una helmets! Make una sharpen una spears! Make una wear una protection!
5 The LORD ask say But wetin I see? Dem dey turn back in fear. Dem beat their soldier back; fear catch them, dem run fast as dem fit and dem no look back.
6 Those wey dey run fast no fit get away; the soldiers no fit escape. In the north, by the Euphrates, dem stumble and fall.
7 Who be this wey rise like Nile, like river wey dey fill hin bank with water?
8 Na Egypt, e dey rise like Nile, like river wey dey fill hin bank with water. Egypt talk say, I go rise and cover the world; I go destroy cities and the people wey dey live for there.
9 Command the horses make dem go and the chariot make dem roll! Send soldiers out: men from Ethiopia and Libya, dey carry shields, and skilled arrowmen from Lydia.
10 Na the day of the Sovereign LORD Almighty be this: he go take revenge today; he go punish him enemies today. Him sword go chop them and drink their blood until e don belleful. Today the Almighty go sacrifice him victims for north, by the Euphrates.
11 People of Egypt, make una go Gilead, and look for medicine! All una medicine don become useless; nothing fit heal una.
12 Nations don hear about una shame; everyone don hear una dey cry. One soldier dey fall on top another, and both of them fall for ground.
13 When king Nebuchadnezzar of Babylonia come attack Egypt, God speak to me. He talk say,
14 Announce am in the towns of Egypt, for Migdol, Memphis, and Tahpanhes: Make una get ready to defend unaselves; all wetin una get go destroy for war!
15 Why una mighty god Apis don fall? God don strike him down!
16 Una soldier don stumble and fall; each one dey tell the other say, Hurry! Make we go home to our people and escape the sword of the enemy!
17 Make you give the king of Egypt new name - Noisy Braggart wey miss him chance.
18 I, the LORD Almighty, I be king. I be the living God. As Mount Tabor tall pass other mountain and Mount Carmel stand high above the sea, naso the strength of the one wey attack una go be.
19 Make una ready so that dem fit take una as prisoner, una people of Egypt! Memphis go turn desert, a place where nobody dey live.
20 Egypt be like fine cow, wey poisonous fly from the north attack.
21 Even the soldier wey she hire dey useless like calves. Dem no stand and fight; all of them turn back and run. Their day of trouble don come, their time of destruction.
22 Egypt dey run away, dey make sound like snake, as the enemy army dey come close. Dem attack her with axes like men wey dey cut down trees
23 and dey destroy a thick forest. Their men too plenty to count; their soldiers plenty pass locusts.
24 Shame don catch the people of Egypt; people of the north don defeat them. I, the LORD, don talk.
25 The LORD Almighty, the God of Israel, talk say, I go punish Amon, the god of Thebes, together with Egypt and hin gods and kings. I go take the king of Egypt and all those wey trust in him,
26 and give them to people wey wan kill them, to king Nebuchadnezzar of Babylonia and him army. But later on, people go live for Egypt again, as dem do before. I, the LORD, don talk.
27 My people, make una no fear, people of Israel, make una no fear. I go rescue una from that far land, from the land wey una be prisoners. Una go come back home and live in peace; una go dey safe, and nobody go make una fear.
28 I go come to una and save una. I go destroy all the nations wey I don scatter una, but I no go destroy una. I no go allow una go unpunished, but when I punish una, I go dey fair. I, the LORD, don talk.