Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

James 3

1 My brodas and sistas, evribodi nor go fit bi tisha, bikos yu no sey wi wey dey tish, na awa jojment go big pas,

2 bikos wi dey mak meni mistak. If pesin nor dey mak mistak for wetin e dey tok, dat min sey e dey pafet and e go fit kontrol en bodi.

3 If wi tie rope for horse mout mak e for obey us, dat min sey wi dey kontrol en bodi.

4 Luk ship for wota: E big wel-wel and na strong briz dey fit push am, bot na won smol wheel di pilot dey yuz tak kontrol am.

5 Na so di tongue bi tu: naim smol pas for di bodi, bot di tins wey e fit du big wel-wel. Mak una tink haw smol fire fit burn big fores rish groun.

6 Di tongue na fire! Na der bad tins ful pas for pesin bodi. E dey spoil di hol bodi and kause fire for pesin life and dis kaind fire dey kom from hell.

7 Humanbin dey fit kontrol bird, anima wey dey krip for groun and anima wey dey stay for wota.

8 Bot nobodi don eva fit kontrol en tongue wel. Di tongue na bad tin wey nor dey stay won place, bikos e get poison wey fit kil pesin.

9 Na di tongue wi tak dey praiz awa papa and Oga Jisos Kraist and naim wi stil dey yuz tak kos pipol wey God kreate laik ensef.

10 My brodas and sistas, na di same tongue wi dey yuz tak praiz and kos pipol. Bot e nor sopoz bi laik dat.

11 Spring wey dey kom out from groun, nor dey bring out fresh and bita wota from di same place, abi e dey du so?

12 My brodas and sistas, fig tri go fit bear olive, abi vine fit bear fig? So tu, spring wey dey bring out salt wota, nor go fit bring fresh wota at-all.

13 Hu get sense among una? Di way di pesin dey bihav go show di gentolnes wey wisdom dey bring.

14 Bot if jelosi and selfishnes dey en maind, mak e nor boast and lai against di trut.

15 Dat kaind wisdom nor kom from God, bot e kom from dis eart wey wiked wel-wel.

16 Bikos wer jelosi and selfishnes dey, wahala and bad tins wey pipol dey du, dey der tu.

17 Bot God wisdom dey pure; e get peace; dey gentol; dey asept pipol and gud frut and mesi ful am; e nor dey du wayo or pritend.

18 Pipol wey nor laik trobol, dey plant frut wey dey bring raitiousnes.

Open Bible reader