Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 6
1 I see God, in the year wey King Uzziah die. He dey sit for him throne, high and exalted, and him robe fill the whole Temple.
2 Flaming creatures dey stand round him, each of them get six wings. Each creature dey use two wings cover hin face, and cover hin body with two wings, and e dey use the remaining two to dey fly.
3 Dem dey tell each other say: "Holy, holy, holy! Him glory fill the world."
4 The sound of their voice dey shake the foundation of the Temple, and smoke fill Temple hinself.
5 I talk say, "Hope no dey for me! I don enter trouble because every word wey dey pass for my lip na sin, and I dey live among people wey dey word na sin. And yet, I don see the king, the Almighty God, with my own eyes!"
6 Then one of the creatures fly down con meet me, e carry burning coal wey e don take from the altar with pair of tongs.
7 He use the burning coal touch my lip and talk say, "This don toch your lips, and now your guilt don go and God don forgive you your sin."
8 Then I hear God talk say, "Who I go send? Who go be my messenger?" I answer say, "I goo go! Make you send me!"
9 So he tell me say make I go say make I give people this message: "No matter how much una listen, una no go understand. No matter how much una look, una no go fit know wetin dey happen."
10 Then he tell me say, "Make i make mind of these people dull, make you make their ears deaf, and their eyes blind, so that dem no go fit see or hear or understand. If them see or hear, dem fit turn to me and be heal."
11 I ask say, God, "How long e go be like this?" He answer say, "Until the city don destroy and empty-until nobody dey live for those houses again-until the land self turn empty waste.
12 I go send the people go far away and I go empty the whole land.
13 Even if one person out of ten remain for the land, dem go destroy too; he go be like pieces of oak tree wey dem don cut go down." {The pieces dey represent new beginning for people of God}