Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 48
1 Make una listen to this, people of Israel, una wey descend from Judah: una dey swear by the name of the LORD and una claim to dey worship the God of Israel- but una no mean wetin una say.
2 And yet una dey proud to talk say una be citizen of the holy city and say una depend on God of Israel, wey him name be the LORD Almighty.
3 God tell Israel say, E don tey wey I don predict wetin go happen; and I make am happen suddenly.
4 I know say una get srong head, wey strong like iron and no dey bend like brone.
5 And so e don tey wey I don predict una future, I don announce the event before them happen, to prevent una to claim say na una idols and images make them happen.
6 Everything wey I don talk don happen now; una go gree say my prediction dey right. Now I go tell una new things wey go happen, event wey I never tell una before.
7 I dey only make them happen; nothing like this don happen for past. If e don happen, una for claim say una know everything about am.
8 I know say person no fit trust una, dem don know una as rebel. Na the reason why una never hear about this at all, why any word of am never come to una ears.
9 I dey hold my angerso that people go praise my name,; I dey keep am back and no go destroy una.
10 I don use fire of suffering test una, like them dey pass silver through fire. But I dont find out say una dey useless.
11 Wetin I do na for my own sake- I no go allow shame catch my people or allow make anybody share the glory wey suppose be my own and my own alone.
12 God talk say, , make una listen to me, Israel, the people wey I don call! I be God, the first, the last, the only God!
13 Na my hands make foundation of the earth and spread out heaven. When I con call for earth and sky, dem dey come at ones to come present themselves.
14 all of una make una garther together and listen,! None of the gods fit predict say the man wey I don chose go attack Babylon; he go do wetin I wan make he do.
15 Na me be the one wey speak and call him; I lead am out and I give am success.
16 Now make una come close to me and hear wetin I say. Na since beginning I don speak openly, and I dey always make my word come true. {Now the Sovereign LORD don give me him power and he don send me.}
17 The holy God of Israel, the LORD, wey save una, talk say: I be the LORD una God, the one wey wan teach una for una own good. and the one one wey direct una in the way wey una suppose dey go.
18 If una don listen to my commands! Then blessing for don flow for una like streams wey no dey dry! Victory for don come to una like waves wey dey roll for shore.
19 Una descendant for plenty like sand, and I for don make sure say dem perish.
20 Make una commot from Babylon, make una go free! Make una shout with happiness; make everybody no about am; God don save him servant Israel!
21 When God lead him people through hot, dry desert, dem no suffer for water. He make water to dey come from rock for them; he open the rock and water dem flow come out.
22 God talk say, safety no dey safe.