Nigerian Pidgin Bible
Isaiah 32
1 One dey dey come wey one king go rule with integrity, and national leader wey dey lead with justice.
2 Each of them go be like shelter from wind and place to hide from storm. Dem go be like stream wey dey flow from desert, like shadow of giant rock for barren land.
3 Their eyes and ear go open to wetin people need.
4 Dem no go dey hurry again, but dem go dey act with understanding and dem go say wetin dem mean.
5 No one go think say fool get honour or think say rascal dey honest.
6 A fool dey talk without sense and dey think of evil things to do. Everything wey he dey do and wetin he dey talk na insult dem be to the LORD, and he no dey feed people wey dey hungry or give people wey won drink water anything make dem drink.
7 A stupid person na evil wey dey do evil things; he dey plan to destroy the poor with lies and he no dey allow dem get wetin be their own,
8 But person wey get honour dey act with honesty and dey defend wetin dey right.
9 Una women wey dey live easy life, wey no get worry, make una hear wetin I dey talk.
1 Una fit dey satisfied now, but this time next year una go dey for pain because grape no go dey for una to gather.
1 Una don dey live easy life, wey no get worry; but now, make una shake with fear! Make una remove una clothe and make una tie rag around una waist.
1 Make una beat una breast in sorrow because the fertile field and vineyard don destroy,
1 thorn bushes and wild roses dey grow on top my people land. Make una cry for help make una cry for all the houses where people dey happy before and cry for the city wey dey full of live before.
1 Them go even abandon the palace and the capital city go turn empty place. Home and wall wey dey guard them go destroy forever. Wild donkey go dey waka for there, and sheep go find grassland for there.
1 But God go send him spirit to us once more. The waste land go become fertile, and field go produce rich crop.
1 Righteousness and justice go dey everywhere in the land.
1 Because everyone go do wetin dey right, peace and security go dey forever.
1 People of God go dey free from worries, and their home go dey peaceful and safe.
1 But before all this happen, rain go fall on top the forest, and the city go destroy.}
2 Everybody go dey happy with plenty water for the crop and dem go safe grassland everywhere for donkey and cattle.