Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Isaiah 28

1 Look at samaria the glorious crown of Israel drunkard e dey on top fertile land, the Samarian think say their city na beautiful crown of flower but wine don make them high and this beautiful flower na plant wey dey die.

2 God get person wey dey strong and powerful wey dey ready to attack them, person wey go come like hailstone, wey go come like heavy rain, like a rushing flood, wey go destroy the land.

3 Dem go match on top the pride of those drunken leaders.

4 The fading glory of those drunken leaders go disappear like first fig of the season, wey people pick and chop as soon as e don ripe.

5 A day dey come when Almighty God go be like glorious crown of flower for him people wey survive.

6 He go give sense of justice to those wey dey serve as judge, and he go encourage those wey defend the city gate from attack.

7 Even the prophet and priest don drunk so tey dem dey stagger. Dem don drink plenty and strong wine and dem con dey confuse. The prophets don drunk too much wey be say dem no fit understand the vision wey God send, and the priest dey too drunk that dem no fit decide the case wey dem bring to them.

8 Na vomit cover all the table where dem sit, and clean spot no remain for there.

9 Dem con complain about me, dem say, “Who that man think say he dey teach? Who need him message? E only good for pikins wey just stop to dey suck him mama breast!

1 He dey try to dey teach us letter by letter, line by line, lesson by lesson.”

1 If una no go listen to me, then God go use foreigners speak strange language to teach una lesson.

1 He dey give rest and comfort to all of una, but una no gree listen to him.

1 Na the reason why god go teach una letter by letter, line by line, lesson by lesson be that. Then una go fall with every step wey una take. Una go wound, enter trap, and una go turn prisoner.

1 Now una wey get strong head wey dey rule here for Jerusalem on top this people, make una listen to wetin God dey say,

1 Una brag say una don make deal with death and una don reach agreement with world of the dead. Una dey sure say disaster no go reach una when e come, because una depend on lies and deceit to keep una safe.

1 Na wetin Almighty God talk be be this: “I dey place foundation wey dey strong and firm for Zion. I dey put solid cornerstone inside am wey I write the words, ‘Faith wey dey firm also dey patient.’

1 Na Justice go be measuring line for the foundation, and honesty go be the plumb line.” Hailstone go wipe away all the lies wey una depend on, and flood go destroy una security.

1 The deal wey una don make with death go end, and una agreement with world of the dead go cancel. When disaster come, e go oversome una.

1 E go strike una again and again, e go strike una morning after morning. Una go need bear am day and night. Each new message from god go bring una fear!

2 Una go be like person in the proverb, wey dey try sleep in bed wey dey too short to stretch on., with blanket wey dey too small to take wrap himself.

2 God go fight as he don fight on top Mount Perazim and for valley of Gibeon, so that he go fit do wetin he don talk say he go do- e dey strange as him action fit be. He go complete him work, him strange work.

2 Make una no laugh at the warning wey I dey give una! If una laugh, e go even dey harder for una to escape. I don hear Almighty God decision say he go destroy the whole country.

2 Make una listen to wetin I dey say; make una pay attention to wetin I dey tell una.

2 No farmer dey prepare him field every time and dey get am ready to dey sow.

2 Once he don prepare the soil, he go sow the seed of herbs like dill and cumin. He go sow rows of wheat and barley, and he go sow other grain for edge of him field.

2 He know how to dey do him work, because God don teach him.

2 He never use heavy club take beat out dill seeds or cumin seed; instead he dey use light stick of proper size.

2 He no dey destroy the wheat when e dey separate am am, and he know how to dey separate am by driving cart on top am without bruising the grains.

2 Na from Almighty God all this wisdom come from. Na wise plans God dey make, and dem dey always prosper!

Open Bible reader