Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Isaiah 15

1 Na message about Moab be this. The cities of Ar and Kir don destroy in single night, and silence don cover the land of Moab.

2 People of Dibon climb the hill to go cry for shrine. The people of Moab con dey cry over the city of Nebo and Medeba; dem don shave their head and the bears in sorrow,

3 The people wey dey the street dey wear sackcloth; and people dey cry and mourn for city square and housestops.

4 People of Heshbon and Elealeh dey cry, and people fit hear their cry from far away of Jahaz. Even the soldiers dey shake; their courage don go.

5 My heart dey cry out for Moab! The people don run go town of Zoar, and go Eglath Shelishiyah.some climb the road wey go Luhith, dem dey cry as dem dey go; some escape go Horonaim, dem dey cry very loud.

6 The stream of Nimrim don dry, the grass wey dey beside am don dry, and nothing green remain for there again.

7 People pass the Valley of Willows, dem dey try to escape with all their possession.

8 Na for everywhere for border of Moab people dey hear their cry. People for the town of Eglaim and Beerelim dey hear am.

9 The river for the town of Dibon dey red with blood, and God get something even worse in store for people wey dey there. Yes, I go send lion to go chop the people wey remain for Moab.

Open Bible reader