Nigerian Pidgin Bible
Hosea 10
1 People of Israel be like grapevine wey get full grapes. The more dem prosper, the more alter wey dem dey build. The more productive their land dey, the more beautiful dem make the holy stone pillar wey dem dey worship.
2 The people wey deceit full their heart must suffer for their sin now. God go break their alter down and go destroy their holy pillar.
3 These people go soon start dey say, "We no get king because we no fear God. But wetin king fit do for us self?
4 Dem talk empty words and dey make false promises and useless covenant. Justice don become injustice, and e dey grow like poison weed for field wey dem plough.
5 People wey dey live for city of Samaria go fear and go mourn the loss of gold bull for Bethaven. Them and the priest wey serve the idol go weep over am. Dem go cry when the beautiful gold don go.
6 Dem go take the idol go Assyria as respect for the great emperor. People of Israel go dey disgraced and put to shame because of the advice wey dem follow.
7 Dem go carry their king away, like log of wood on top water.
8 The hilltop shrine of Aven, where people of Israel dey worship idol, go destroy. Thorns and weed go grow over their alter. The people go call the mountain say, "Hide us!" and the hill say, "Cover us!"
9 God talk say, "People of Israel no stop to dey sin against me since dem sin for Gibeah. So I go catch up with them for Gibeah.
10 I go attack this sinful people and punish them. Nations go join together against them, and dem go be punished for plenty sin.
11 "Israel be like well-trained young cow, we dey ready and willing to dey separate grain. But I don decide to put yoke on top her beautiful neck and I go use her for hard work. I make Judah pull the plough and make Israel pull the arrow.
12 I talk say, "Plough new ground for unaselves, make una plant righteousness, and make una reap the blessing wey una work for God go produce. E don reach time make una turn to me, una God, and I go pour blessing on top una."
13 But instead, una plant evil and reap hin harvest. Una don chop the fruit wey una lies produce. "Because una trust on una chariot and in plenty of una soldier.
14 War go come to una people, and all una strong wall go destroy. E go be like the day wey king Shalman destroy city of Betharbel for battle, and crush their mother and children to death.
15 Na wetin go happen to una be that, people of Bethel, because of the terrible things wey una don do. As soon as the battle start, king of Israel go die."