Nigerian Pidgin Bible
Hebrews 8
1 Wetin I min bi sey: Wi get High Prist wey sidan for God rite hand side for hevun.
2 Na-im bi di prist wey dey di Holi Tempol wey God build and na der dem for dey woship am.
3 Since all High Prist must offa gifts and sakrifais to God, Kraist tu must offa somtin.
4 If to sey e dey dis wold, e nor for bi prist at-all, since na tru Mosis law dem tak dey shuz prist wey go offa sakrifais.
5 Di prist wok for di Tempol bi laik wetin dey hapun for hevun. Bikos wen Mosis dey won build God haus, God tel am: "Mak sure sey evritin bi laik di design wey I show yu on-top di mountin."
6 Bot Kraist ministri big and beta pas dia own and na di new kovenant (wey bi di new agriment) beta pas. Bikos na tru God promis dis kovenant tak kom, so Kraist don bi di middo-man bitwin wi and God.
7 If to sey di first kovenant gud wel-wel, den wi nor for nid anoda won.
8 Bot God si fault for insaid, so E kon sey, "Di day wey I go mak new agriment wit Izrel and Juda haus, dey kom.
9 "E nor go bi laik di kovenant wey I mak wit dia gran-gran papa dem wen I tak dem komot from Egypt, bikos dem break dat kovenant and I kon turn against dem."
10 Bot naw, "Dis na my new kovenant (wey bi di new agriment): Di taim dey kom wen I go put my laws for dia mout and rite am for dia heart. I go bi dia God and dem go bi my pipol.
11 "Dem nor nid to tish won anoda abaut mi wey bi dia God, bikos all of dem, both smol and big, go no mi.
12 "I go forgiv dem for all di wiked tins wey dem don du and I nor go rimemba dia sins again."
13 Wen God tok abaut di new kovenant, E min sey di first won nor mata again. And enitin wey don old and nor get yuz again, go soon disapier.