Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Hebrews 5

1 Na God dey shuz High Prist wey go represent pipol for en present. Di prist dey offa both gift and sakrifais for dia sins.

2 Di High Prist fit sori for doz wey sin, bikos dem nor no wetin dem sopoz no, since en ensef dey sin tu.

3 Bikos of dis, e dey offa sakrifais for en sin and di pipol own.

4 Nobodi dey fit bi High Prist wit en pawa bikos e wont mak pipol onor am, bot na onli doz wey God kol to bi prist, jos as E kol Aaron.

5 Kraist nor praiz ensef wen e bikom High Prist, bot na God praiz am wen E sey, "Yu bi my Pikin! Today, I don bikom yor Papa."

6 God stil sey, "Yu bi prist foreva as Melkizedek bi."

7 Wen Jisos stil dey dis eart, e pray and krai to God wey go save am from deat. God hear en prayas, bikos e obey God for evritin.

8 Ivun doh e bi God Pikin, na tru all di tins wey e sofa, e tak learn haw to obey.

9 Wen God don mak Kraist pafet finish, e kon save evribodi wey obey am.

10 God mak Kraist to bi High Prist laik Melkizedek.

11 Wi get meni tins to tok, bot dem nor eazi to esplain, bikos una nor dey gri obey.

12 E don tey wen una bi Kristen, so by naw, una sopoz to dey tish odas. Insted, una stil wont mak pesin kom tish una di first tin wey dey God wod. Una stil dey drink milk, insted of una to dey chop solid fud.

13 Enibodi wey stil dey drink milk, bi laik smol pikin wey nor no gud from bad.

14 Bot solid fud na for mature pipol and dem get beta sense to no wetin dey gud and bad.

Open Bible reader