Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Hebrews 3

1 My brodas and sistas wey God shuz, mak una tink abaut dis Jisos wey God send kom and na-im bi di High Prist wey wi biliv.

2 E obey God wey shuz am as High Prist, jos as Mosis obey God.

3 Jos as dem dey praiz pesin wey build fine haus, pas di haus wey e build, na so tu Jisos glori beta pas Mosis own wel-wel!

4 Na pesin build evri haus, bot di pesin wey build evritin, na God.

5 Tru-tru, Mosis rili obey God as savant and e tok abaut somtins wey God go tok abaut leta.

6 Bot as God Pikin, Jisos dey fateful for God haus. So wi tu go get share for di haus, if wi biliv and get kofident for awa hope wey dey insaid Kraist.

7 As di Holi Spirit tok, "If una hear God vois today, mak una listin to am!

8 "Mak una nor get strong heart for am, bikos na so Izrel pipol du wen God test dem for widanes.

9 "Na for di widanes una papa for test and trai mi for forti years, ivun doh dem si di mirakols wey I du.

10 "I ves wel-wel for dat generashon, so I kon tel dem, 'Una heart nor dey wit mi and una nor gri obey wetin I tok.

11 'So, una nor go eva get res.'"

12 Mak una mak sure sey non of una get bad maind wey go mak una nor biliv, so dat una nor go turn against God wey nor dey die.

13 Bot mak una dey enkorage won anoda evriday, so dat non of una go get bad maind, bikos of sin.

14 Bikos wi go bi Jisos Kraist frend, if wi hol awa fate strong go rish end.

15 Bot as dem rite am, "I wish sey una go du wetin e tok, so dat una nor go get strong heart laik Izrel pipol wen dem dey widanes."

16 Na hu bi di pipol wey nor listin to God, ivun doh dem hear en vois? Nor bi pipol wey Mosis lid kom out from Egypt?

17 Na hu mak God ves wel-wel for forti years? Nor bi doz sinas wey dia deat bodi skata for widanes?

18 Na hu God swear for sey, dem nor go eva get res of maind, nor bi doz wey disobey am?

19 So for dat taim, doz pipol nor enta di land wey God promis dem, bikos dem nor biliv am.

Open Bible reader