Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Hebrews 1

1 Bifor-bifor, God tok to awa gran-gran papa dem for meni ways, tru di profets,

2 bot naw, E dey tok to us tru en pikin wey get evritin and na tru am, E kreate di wold.

3 Na dis pikin bi God image and e dey show God glori. Naim dey kip evritin wey dey dis wold wit en pawa. Afta e don die mak God for forgiv evribodi dia sins, e kon go sidan for God rite side for hevun.

4 E big pas di angels, jos as di name wey God gi-am big pas angels own tu.

5 Na wish angel God tel sey, "Yu bi my pikin, today I don bikom yor Papa"? Or as E tok for anoda place sey, "I go bi yor Papa and yu go bi my pikin?"

6 Bot wen God won send en first born enta dis wold, E sey: "Mak all my angels woship am."

7 God tok abaut di angels sey, "I mak my angels and my savants spirit to dey burn laik fire,"

8 bot konsanin en pikin, E sey, "Yu bi God! Yor kindom go dey foreva and eva and yu go rule yor pipol wit autoriti.

9 "Yu luv to du gud and yu hate wikednes. So God, wey bi yor God don anoint yu wit oil wey dey bring joy and E mak yu dey above yor mates."

10 E stil tel di pikin sey, "For di biginin, na God kreate di eart and na wit en hand E tak mak di hevuns.

11 "Dem go skata, bot God go dey foreva. All of dem go grow kon old laik klot

12 and laik klot and koat, God go fold and shange dem, bot God nor dey shange and en life nor go eva end."

13 Na wish angel God tel, "Sidan for my rite hand ontil I go put all yor enemis unda yor leg"?

14 All di angels na savants and na dem God send go prish for pipol wey go get salvashon.

Open Bible reader