Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Habakkuk 1

1 Na the message wey God show prophet Habakkuk.

2 O LORD, how long I go call before you go hear and save us from violence?

3 Why you make me see this kind trouble? How you go dey look this kind wrongdoing? Destruction and violence surround me, fighting and quarrelling dey everywhere.

4 The law dey weak and useless, and dem no dey do justice. Evil people dey get better pass the righteous, and den justice change.

5 And God tell him people, "Dey watch the nations around una, and wetin una go see go surprise una. I go do wetin una no go believe when una hear am.

6 I dey bring people of Babylonia come power, dem be violent, restless people. Dem dey march across world so dem go conquer other land.

7 The Babylonians go scare other people. Dem go do wetin dem won do and go where dem won go.

8 "Their horses go fast pass leopard, wicked pass hungry wolves. Their horseemen go come from faraway place, dem go attack their enemy quickly, like hungry eagle wey dey come from sky.

9 Dem dey ready to fight everytime, dem dey gather slaves wey plenty like sand.

10 Babylonia soldier go laugh king of other nations. Dem go make jest of foreign rulers. The Babylonia soldier go laugh the city wey get walls wey strong and tall. Dem go build dirty road go the top, defeat the city easily.

11 Then dem go disappear like wind, those sinsful people wey dey only worship their own strength.

12 God, na only you dey live forever! You be the only God wey never die! God, you create Babylonia make dem do wetin dem suppose do. Our rock, you create dem make dem punish others.

13 But how you fit dey look this kind evil men? Your eyes dey too holy to dey see evil, and you no fit dey look people wey dey wrong, so why you dey silent dey watch evil people dey destroy people wey righteous pass them?

14 The people wey you put for this earth be like fish or reptiles wey no get leader.

15 Naso enemy con carry dem as slave with hooks and nets. Dem dey happy for wetin dem catch.

16 Dem woship their net and offer sacrifices give dem, because their net give dem best of everything.

17 Dem go use their sword forever? Dem go continue to dey destroy nation without mercy?

Open Bible reader