Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Genesis 50

1 Joseph come throw himself on him father and he begin dey cry and dey kiss him face.

2 Joseph come give order say make them go embalm him father body.

3 Na forty days wey be normal timing dem take embalm am. Egyptians come mourn him for seventy days.

4 When time to dey mourn come finish, Joseph tell king officials say, "I beg help me take this message to the king.

5 When my father want die, I promise him say I go bury him for the tomb wey him don prepare for Canaan land. So I beg allow me make I go bury my father and I go come back."

6 Pharaoh come answer him say, "Go bury your father as you promise say you go do".

7 Naso Joseph go bury him father. All king official's, senior men for him court and all leading men for Egypt go with Joseph.

8 Him family, him brothers and the rest of him father family, all of them go with him. Na only their small children, their sheep, goats and cattle stay for Goshen region.

9 Men of chariots and men wey dey ride horse also go with him. 11Na each group them be.

10 When dem reach the threshing place for Atad wey dey near Jordan river, dem come mourn loud for long time. Joseph do morning ceremony for seven days.

12 When people of Canaan see people wey dey mourn for Atad, them say, "Na deep morning ceremony Egyptians dey hold for here". Na why them name the place Abel Mizraim.

13 Naso Jacob sons do as he don command them. Dem carry him body to Canaan and dem bury am in the cave for Machpelah wey dey east of Mamre for the field wey Abraham don buy from Ephron the Hittite for burial ground.

14 After Joseph don bury him father, he return go Egypt with him brothers and everybody wey don go with him for the burial.

15 After their father don die, Joseph brothers come say, "We no know whether Joseph still hate us and he dey plan to pay us back for the evil wey we don do to him.

16 Naso dem send message to Joseph say, "Before our father die,

17 he say make we ask you say, "I beg forgive the crime wey your brothers don do when dem do you wrong. I beg forgive the wrong wey we the servants of your God don do." Joseph come cry when he get the message.

18 Him brothers come meet him and dem bow down before him. We dey here before you as your slaves, but

19 Joseph tell them say, "No fear, I no fit put myself in place of God,

20 una plan evil for me but God don turn am to good so that He go save lives of many people wey dey alive today because of wetin happen.

21 Una no need to fear anything, I go take care of una and una children". Naso he assure them again with kind words wey touch their hearts.

22 Joseph continue to dey live in Egypt with him father family. He be one hundred and ten years old when he die.

23 He see Ephraim children and grandchildren before he die. He receive children of Machir wey be son of Manasseh to the family.

24 He tell him brothers say, "I go soon die but God go certainly take care of una and He go lead una out of this land go the land wey He don promise Abraham, Isaac and Jacob".

25 Joseph come ask him people to make a promise and he say, "Promise me say when God lead una to that land, una go take my body with una."

26 Naso Joseph die for Egypt when he dey age of one hundred and ten years. Dem embalm him body and dem put am inside coffin.

Open Bible reader