Nigerian Pidgin Bible
Genesis 45
1 Joseph no fit control him feelings for him servant front, he come tell them say make dem commot. Nobody dey with him when he tell him brothers who him be.
2 As he cry loud, Egyptians come hear him cry, dem carry the news go Pharaoh palace.
3 He come tell him brothers say, "I be Joseph, my father still dey alive?" As him brothers hear am, fear come catch them wey them no fit answer.
4 Joseph come tell them say, make dem come close to am, naso dem come close. He come tell them say, "I be your brother Joseph wey una sell go slave for Egypt.
5 Make una no vex or blame unaselves say una sell me for here. Na God send me before una, so that I go fit safe people lives.
6 Na only second year of hunger be this for the land, five more years still dey wey be say planting and reaping no go dey.
7 God send me before una so that I go fit help una for this good way and to make sure say una and una descendants go survive.
8 So, no be una send me here, but na God. He don make me king official wey high pass, na me dey in charge of the country, na me be the ruler for Egypt".
9 Now go meet my father and tell am say na wetin him son Joseph talk be this: "God don make me ruler for Egypt and make he no waste time come back to me.
10 Una fit live for Goshen region where una go fit dey near me. Una, una children, una sheep, goat, una cattle, and everything wey una get.
11 If una dey Goshen I go fit take care of una. Five years of famine still dey and I no want make hunger kill una, una family and una livestock.
12 Now all of una and Benjamin don see say I be Joseph for real.
13 Tell my father how I don dey powerful for Egypt and tell him everything wey una don see. Make una go quick go bring him for here".
14 He come hug Benjamin him brother, he begin dey cry. Benjamin come cry too as he hug him brother.
15 As he dey cry, he dey hug him brothers one by one and he dey kiss them. After that, him brothers come begin dey talk with him.
16 When news reach Pharaoh palace say Joseph brothers don come, Pharaoh and him officials come dey happy.
17 He tell Joseph say, "where your brothers make them load their animals and make them return to Canaan land.
18 Make them bring their father and their family come here. I go give them best land for Egypt and dem go get more than enough.
19 Tell them say make them carry wagon go bring their wives and children and make them carry their father come with them. Make them
20 no worry to leave their things behind because the best wey dey for Egypt go be their own".
21 Jacob sons come do as them tell them. Joseph give them wagons as the king don talk am and food wey dem go eat as dem dey go back.
22 He give them clothes make them change, he come give Benjamin three hundred pieces of silver and five clothes wey him go use change.
23 He come send him father ten donkeys wey Egyptian goods full am and ten donkeys wey dey full of corn and bread and other food wey dem go eat for road.
24 He come send him brothers say, make dem dey go and he tell them say make them no fight for road.
25 Dem come leave Egypt and dem go meet their father for Canaan.
26 Dem tell him say, "Joseph still dey alive, na him be the ruler for Egypt". But Jacob no fit believe them.
27 Dem come tell him the things wey Joseph don tell them. When he see the wagon wey Joseph send make dem come use carry am go Egypt, he come recover from him shock.
28 He come say, "my son Joseph still dey alive? Na the only thing wey I dey ask be this. Make I go see him before I die."