Nigerian Pidgin Bible
Galatians 5
1 Mak una nor dey kari load for head laik slave again, bot mak una stand strong for groun, bikos Kraist don mak us fri.
2 Una dey hear! Mi wey bi Pol dey tel una sey, if dem sekonsaiz una, den Kraist nor min enitin to una again.
3 And I dey warn evribodi; enibodi wey gri mak dem sekonsaiz am, must obey evri oda tin wey di law tok.
4 Pipol wey wont mak pipol no sey dem dey gud, bikos dem dey kip di law, dem don alredi fal komot from God grace.
5 Bikos na tru fate for God Spirit, naim wi hope sey, God go mak us dey gud for en eye.
6 For Kraist, e nor mata weda dem sekonsaiz pesin or not; di onli tin wey mata, na fate wey dey wok tru luv.
7 Bifor, una dey du wel; bot naw, hu sey mak una nor obey di trut?
8 Nor bi God wey kol una sey mak una dey du laik dis!
9 Na smol yist dey mak bread raiz!
10 I get maind sey, God nor go let una listin to anoda pesin. Bot di pesin wey dey konfuz una, go face jojment, no mata hu e bi.
11 Naw, my brodas and sistas, if I stil dey prish abaut haw dem go tak sekonsaiz una, why pipol dey trobol mi? If na so, my tishin abaut Kraist kros nor sopoz kause eni trobol.
12 I wish sey doz wey dey disturb una go-go sekonsaiz demsef!
13 My brodas and sistas, God don kol una mak una dey fri; bot mak una nor yuz di fridom wey God giv una enihaw, insted mak una luv ish oda.
14 Bikos if dem add di hol law togeda, dem go kon bi won komandment wey sey, "Mak yu luv yor nebor as yu luv yorsef."
15 Bot if una kontinu to kworel among unasef; una go fit wound or kil ish oda by mistak.
16 I tel una, mak una let di Spirit direct una life and una nor go du wetin di flesh wont.
17 Bikos di tins wey di bodi laik, difren from wetin di Spirit laik and wetin di Spirit wont, nor dey gri wit wetin di flesh wont.
18 Bot if una alow di Spirit kontrol una, den una nor dey unda di law again.
19 Na di tins wey di flesh dey du bi dis: to slip wit pesin wey yu nor mari; to get bad maind; to opres pipol;
20 to dey serv juju; dey du magic; kworel-kworel life; faiti-faiti; jelosi; enihaw vesnashon; long-trot; tins wey dey skata pipol;
21 bad bele; kili-kili; to dey drink enihaw and dey du oda tins laik all dis wons. I dey warn una naw as I don warn una bifor sey, pipol wey dey du dis kaind tins, nor go enta God kindom!
22 Bot di frut wey di Holi Spirit dey bear insaid us; na luv, joy, peace, patient, kindnes, gudnes, faithfulnes,
23 gentolnes and to kontrol awasef. Di law nor dey against all dis tins.
24 Pipol wey dey insaid Kraist don kil dia flesh wit all di bad tins wey di flesh dey laik to du.
25 If di Holi Spirit dey insaid us, den mak wi dey liv awa life as di Holi Spirit wont.
26 Mak wi nor dey kari bodi up and dey du wetin go ves pipol or dey jelos won anoda.