Nigerian Pidgin Bible
Galatians 4
1 Wetin I min bi sey, di pesin wey inherit en papa propati and e stil bi smol pikin, e nor dey difren from savant, ivun doh na en get evritin.
2 Bot e go dey unda hu dey gaid am, ontil di taim wey en papa tok, go rish.
3 Na so e bi wit us wen wi smol; wi dey unda di pawa wey dey kontrol dis wold,
4 bot wen di rite taim rish, God kon send en pikin wey wuman born unda di law,
5 mak e save pipol wey dey unda di law, so dat God go mak us en own shildren kon giv us awa own propati.
6 Since wi bi God shildren, E put en Holi Spirit insaid us and naim mak us dey fit kol am, "Abba! Fada!"
7 So, una nor bi slave again, bot una don bi God pikin and since una bi God shildren, una go get God propati tu.
8 Bifor-bifor, wen una nor no God, una dey du bad-bad tins.
9 Bot naw wey una don no am (or abi mak I sey God don no una), why una stil dey folo all dis wik and yeye pawas? Una won bi dia slave again?
10 Dat taim, una folo dia tradishon.
11 I dey fear sey mak di wok wey I du among una, nor waste.
12 My brodas and sistas, I beg, mak una bi laik mi, as I don bi laik una, bikos una nor du mi eni bad tin!
13 Bot wen I first prish di gospol giv una, una no sey I wey nor wel,
14 ivun doh my siknes na problem to una, una nor laff or driv mi. Insted, una welkom mi laik God angel; laik sey na mi bi Jisos Kraist!
15 Naw, na wetin don hapun to una hapines? I no sey, if to sey e dey posibol, una for pul una eye giv mi!
16 So, I don bikom una enemi, bikos I dey tel una di trut?
17 Di pipol wey won disiv una dey trit una wel, bot dem nor dey du-am wit beta maind; bikos dem wont mak una liv mi kon folo dem.
18 Bot e gud mak una dey trit odas wel, so-far na for gud rizin and nor bi onli wen I dey wit una.
19 My shildren! Jos laik wuman wey won born, I dey feel pain for una, ontil Kraist pawa go dey insaid una life!
20 Haw I wish sey I dey wit una naw, so dat I go no haw to trit una, bikos I dey wori abaut una wel-wel.
21 Mak una tel mi, wish of una won dey unda di law? Una nor no wetin di law tok?
22 Dem rite am sey, Abraham get tu boys, won wey di savant wuman born and di oda pikin, na di ril wife born am.
23 Di won wey savant born, na ordinari pikin e bi, bot na tru God promis di ril wife tak born.
24 Beta sense dey for dis stori, bikos dis tu wimen bi laik tu kovenant. Won na from Mount Sinai wey bi laik di shildren wey Hagar, di savant wuman, born.
25 Hagar bi laik Mount Sinai for Arabia kontri and na di same wit Jerusalem wey dey naw, bikos e dey insaid der as slave wit en pikin.
26 Bot di Jerusalem wey kom from hevun, dey fri and na-im bi awa mama.
27 Bikos dem rite am sey, "Wuman! Yu wey neva born, mak yu shaut dey hapi, bikos yu neva labor laik wuman wey won born. Di wuman wey neva born, get plenti shildren pas di wuman wey get husban."
28 Bot my brodas and sistas, una bi shildren wey get promis, jos as Izik bi.
29 For dat taim, di won wey dem born for normal way, trobol di won wey dem born wit di Spirit and na so e bi wit una naw.
30 Bot wetin dem rite for God wod? "Mak yu driv di savant wuman and en pikin komot, bikos di savant pikin nor go share wit di pikin wey di ril wife born."
31 So my brodas and sistas, wi nor bi savant shildren. Na di ril wuman shildren, wi bi.