Nigerian Pidgin Bible
Galatians 1
1 Na mi Pol, rite dis leta, (nor bi humanbin mak mi apostol, bot na Jisos Kraist and God awa Papa wey raiz-am from deat).
2 Mi and di brodas wey dey here, dey grit una wey dey Galatia.
3 Mak God awa Papa and Oga Jisos Kraist grace and peace, dey wit una.
4 Na Jisos die for awa sins, bikos na so God awa Papa wont am.
5 Mak all glori bi en own foreva and eva! Amen.
6 I sopraiz sey una kwik turn bak from di Pesin wey kol una wit en grace kon bigin folo oda tishin.
7 Nor bi sey anoda gospol rili dey, bot som pipol dey disturb una, bikos dem won shange wetin wi prish abaut Kraist.
8 Bot if wi (or angels wey kom from hevun) tish una difren tins from di won wey wi prish giv una bifor, mak God distroi us wit fire!
9 As I tok bifor, I dey repeat am again, if enibodi dey tish difren tins from di wons wey wi prish giv una bifor, mak God trow dat pesin for hell!
10 Una tink sey, I dey trai to du tins mak pipol for laik mi? Abi I dey du wetin God wont? Or I dey trai to mak bele swit pipol? If I dey trai to mak bele swit pipol, den I nor bi Kraist savant again!
11 My brodas and sistas, I wont mak una no sey di gospol wey I dey prish, nor bi humanbin giv mi.
12 Bikos I nor get or learn am from enibodi, bot I get-am tru di revelashon wey Kraist giv mi.
13 Una don hear abaut di kaind life wey I dey liv bifor as Ju pesin; haw I trobol di shosh kon dey trai to distroi am.
14 I grow among Ju pipol kon no di religion pas meni of my mates for my kontri and I no my gran-gran papa dem tradishons.
15 Bot God kol mi wit en grace kon seprate mi ivun bifor dem born mi.
16 E show mi en pikin, so dat I go fit prish abaut am giv Gentai pipol. I nor go mit enibodi mak e advise mi
17 and I nor go Jerusalem go mit pipol wey bi apostol bifor mi, bot I komot der go Arabia, den I kon go bak to Damaskus.
18 Afta tiri years, I go visit Pita for Jerusalem, so dat e go tel mi wetin I go du and I stay wit am for fiftin days.
19 Bot I nor go si eni oda apostol apart from James, wey bi Jisos Kraist broda.
20 God dey si wetin I dey rite, bikos evritin wey I dey rite to una so, na tru!
21 Afta dis, I kon go Syria and Silicia aria.
22 Bot di pipol for di shosh wey dey Judea, nor no mi.
23 Dem onli dey hear sey, "Di pesin wey dey trobol us bifor, don dey prish di mesage wey e bin dey trai to distroi."
24 So dem kon dey praiz God bikos of mi.