Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Ezekiel 32

1 God speak to me on the first day of the twelfth month of twelfth year wey we dey foreign country.

2 He talk say, "Son of man", warn king of Egypt, and give am this message from me say: you dey act like lion among nation, but you pass crocodile wey dey go through river. You come muddy the water and you pollute the river.

3 When plenty nation gather together I go catch you for my net and I go allow them carry the net go ground.

4 I go throw you for ground and I go allow birds and animal make dem come chop you.

5 I go cover mountain and valley with your dead body.

6 I go pour out your blood until e spread over mountain and full the stream.

7 I go cover the sky and the star self no go show, when I go destroy you. The sun go hide under cloud, and moon no go show light.

8 All the light for heaven no go show, and I go leave your world for darkness. I, the Almighty God, don speak.

9 "Plenty nation go fear when I carry news of your destruction go country wey you no know.

10 Plenty nation go shock for the thing wey I don do you. When I flash my sword, kings go fear. All of them go dey shake with fear on the day wey you go fall."

11 The Almighty God tell king of Egypt say, you go face sword of king of Babylonia.

12 I go allow soldier from terrible nation take their sword kill your people. Everything wey you get with all your people wey you dey proud of go destroy.

13 I go kill your cattle for every water hole. Nobody or animal go dey muddy the river again.

14 I go make your water settle and clear and I go make your water calm. I, the Almighty God don speak.

15 When I go empty Egypt and destroy all people wey dey live for there, dem go know say I be God.

16 This warning go turn funeral song for them. Women of nation go sing to dey mourn for Egypt and people wey dey leave for there. I, the Almighty God don speak."

17 The LORD speak to me, on the fifth day of the first month of twlfth year wey we dey foreign country.

18 He talk say, "Son of man", "Cry for all the people wey dey for Egypt. Send dem go down with other powerful nation go world of dead.

19 Tell them say: "Una think say na una fine pass? Una go go down world of the dead and una go dey there with ungodly people.

20 People of Egypt go fall with people wey die for battle. Sword wey go kill all of dem don ready.

21 Greatest hero and those wey don fight for people of Egypt go welcome Egyptian come world of dead. Dem go shout say: the ungodly wey die for battle don come here, and na here dem dey!"

22 Assyria dey there, and grave of her soldier all round am. Dem all die for battle,

23 And their grave dey for inside part of world of dead. All her soldier fall for battle, and their grave dey surround her wall. Yet dey don make land of the fear before.

24 "Elam dey there, and grave of her soldier dey around am. All of dem die for battle. Those foreigner don go deep the ground. Dem make people fear when dem dey alive. But dey go down the deep hole with their shame.

25 Elam dey with those people wey die for battle, and graves of her soldier all surround her. All those foreigners die for battle. Dem scare people when dem dey alive. But dem go down the deep hole with their shame. Dem put dem together with those people wey don die.

26 "Meshech and Tubal dey there, and their grave of their soldier dey around them. All those foreigners die fpr battle, yet dey don scare the living before.

27 But noe dem dey lie down with powerful men wey don die for long! Dem bury them with their weapon of war. Their sword go dey under their head. But their sins dey their born, because when dem dey alive, dem scare people.

28 Naso Egyptians go die among those foreigners wey die for battle.

29 "Edom dey there with her kings and rulers. Dem be powerful soldier, but now dem lie for world of the dead with foreigners wey die for battle.

30 "All the princess of north dey there, Sidonia too dey there. Their power dey cause fear, but now dem go down in shame with those wey die for battle and them put for those foreigners for rest. Dem share the shame of those wey go down world of the dead.

31 "Almighty God talk say, the king of Egypt and his army" go be comfortable when them see those people wey die for battle.

32 "I don make king of Egypt trouble the living, but him and his army go die and lie to rest with foreigners wey die for battle." The Almighty God don talk.

Open Bible reader