Nigerian Pidgin Bible
Ezekiel 28
1 God follow me talk.
2 He talk say, "Son of man", "tell the ruler of Tyre wetin I, the Almighty God, dey tell him: pride don swallow you, and you dey claim say you be god. You talk say na like god you sit down for throne, and sea dey surround you. You fit dey pretend to be god, but, no, you be man, no be God.
3 You think say you wise pass Daniel, say no secret wey you no go know.
4 Your wisdom and skill don make you rich with treasure of gold and silver.
5 You dey make good business deal and you continue to dey make profit. You con dey proud for your wealth!
6 "Now, na wetin I, the Almighty God dey talk be this: because you think say you wise like god,
7 I go bring enemy wey no get mercy to attack you. Dem go destroy all the beautiful things wey you don get by your skill and wisdom.
8 Dem go kill you and send you go grave wey water full.
9 When dem come kill you, you go still claim say you be god? When your face see killer, you go be son of man and no be God at all.
10 You go die like dog in the hand of godless foreigners. I, the Almighty God, don give the command."
11 God follow me talk again.
12 He talk say, "Son of man, sing this sad song about king of tyre. Tell him say, na wetin the lord God say be this: na you be the perfect man- so full of wisdom and handsome perfectly.
13 You live for Eden, garden of God, and dey wear different kind gems: rubies and diamond; topaz, beryl, carnelian, and jasper; sapphire, emeralds, and garnet. You get ornament of gold. Dem make am for you on the day you were created.
14 I put fearful angel for there to dey guard you. You live for my holy mount and yiu dey waka among sparkling gems.
15 Your behaviour perfect from the day wey you were created until you begin to dey do evil.
16 You dey busy to dey buy and sell and na this lead you to violence and sin. So I force you make you leave my holy mountain, and the angel wey dey guard you drive you commot from sparkling gem.
17 You dey proud say you fine, and your fame dey make you dey do like fool. And na because of this I throw you for ground and leave you as warning give other kings.
18 You do evil for buying and selling so tey your place of worship corrupt. Naso I set fire to the city and burn am to ground. All those wey look at you now don see say you don reduce to ashes.
19 You don go, go for ever, and all nations wey don come know you go fear, fear say dem go share from your fate."
20 God tell me say,
21 "Son of man, speak against city of Sidon.
22 Tell the people there wetin I, the Almighty God, dey say about them: Sidon, I be una enemy; people go praise my name for wetin I don do to una. dem go know say I be God, when I show how holy I be by punishing those wey dey live inside una.
23 I go send disease on top una and I go make blood flow for una street. Dem go attack una from every side, and dem go kill all una people. Then una go know say I be God."
24 God talk say, "None of the surrounding nation wey don reject Israel go ever again be like thorns and sting to hurt Israel. Dem go know say I be the Almighty God."
25 The Almighty God talk say, "I go bring back people of Israel from the nation wey I don scatter them, and all the nation go know say I dey holy, and dem go treat me like that. People of Israel go dey live for their own land, the land wey I give my servant Jacob.
26 Dem go live for there in safety. Dem go build house and plant vineyards. I go punish all their neighbour wey dey treat them bad, and Israel go dey safe. And dem go know say I be the LORD their God."