Nigerian Pidgin Bible
Ezekiel 24
1 God speak to m, On the tenth day of the tenth month of ninth year wey we dey foreign country.
2 He talk say, "son of man", write date of today down, because on this date the army of king of Babylonia come surround Jerusalem."
3 Tell my people wey no dey obey me parable wey I, the Almighty God get for them: put pot on top fire make you put water inside am.
4 Put best piece of meat inside am- the shoulder and the leg- put choice bony too.
5 make una use meat of finest sheep; pile wood put under the pot. Make the water boil, make una boil the bone and the meat."
6 This na wetin Almighty God dey say: "The city of killers don enter trouble! E be like pot wey don rust and wey never clean. Dem dey take the meat commot from the pot small small, and no one remain.
7 killer dey the city, but the blood no dey ground where dust fit cover am; it was split am on top ordinary rock.
8 I don leave the blood for there, where e no fit hide, where e dey ask for revenge."
9 This na wetin Almighty God dey say: "The city of killers don enter trouble! I myself go pack the firewood.
10 I go bring more wood! Fan the flame! Cook the meat! Boil the water commot! Burn the bone!
11 Now I go put the empty bronze pot on top coal and allow am red. Then the pot go be pure again after the rust don commot.
12 Although all the rust no go disappear inside the fire.
13 Jerusalem, una immorality action don pollute una. Although I try say make I purify una, but una no gree. Una no go be pure again until una fill the full force of my anger.
14 I, the Almighty God don speak. The time don come make I act. I no go ignore una sin or pity una or get mercy on top una. Una go be punish for wetin una don do." The Almighty God don speak.
15 God speak to me.
16 He talk say, "Son of man", "With one blow I go take away that person wey you love most. Make you no complain or cry or shed tears.
17 Make people no hear your cry. Make you no bareheaded or barefoot as sign say you dey mourn. Make you no cover your face or chop the kind food wey mourners dey chop."
18 Early in the day, I dey talk to people. And tha evening my wife die and next day I don as he don tell me.
19 People ask me say, "why you dey do like this?"
20 Naso I tell them say, "God speak to me and tell me
21 make I give una Israelites this message: una dey proud of strength of the temple. Una dey like to look am and visit am, but God go destroy am. And young member of una family wey remain for Jerusalem go die for war.
22 Then una go do wetin I don do. una no go cover una face or chop the food wey mourners dey chop.
23 Una no go waka bareheaded or barefoot or mourn or cry. Una go waste away because of una sin, and una go cry to one another.
24 Then I go be sign to una; una go do everything wey I don do. God talk say when this happen, una go know say he be the Almighty God."
25 God talk say, "Now, Son of man, I go take the strong Temple wey be their pride and joy, wey dem like to dey look and visit commot from them. And I go take their daughter and son away.
26 on the day wey I go do this, someone wey escape the destruction go come tell una about am.
27 That same day una go get back the power of speech wey una don lose, and una go waka with him. In this way una go be sign to people, and dem go know say I be God."