Nigerian Pidgin Bible
Ezekiel 23
1 God follow me talk.
2 He talk say, "Son of man," Two sisters dey before.
3 When dem young, and dey live for Egypt , dem loss their virginity and dem become prostitute.
4 The older name na Ohomah (She dey represent Samaria), and the young one name na Oholibah (She dey represent Jerusalem). I marry both of them and dem born children give me.
5 Although she be my own, but oholah continue to dey do prostitute and full of lust for her lover from Assyria.
6 Dem be soldier wey wear purple uniform, noblemen and high ranking official; all of dem na handsome young Calvary officers.
7 She be prostitute for all Assyrian officer, her lust make her pollute herself to dey worship Assyrian idol.
8 She continue her prostitute wey she don begin from Egypt, where she lost her virginity. From the time wey she dey young woman, men dey sleep with her and dey treat her like prostitute.
9 Naso I carry her give her Assyrian lover wey she want so much.
10 Dem naked her, collect her sons and daughters, and then kill her with sword. Women everywhere dey talk about her destiny.
11 "Even though say her sister Oholibah see this, she do prostitute go wide pass oholah don do.
12 She too dey full of lust for Assyrian noblemen and officer-soldier wey dey wear bright uniform- and for cavalry officer, and all those handsome young men.
13 I see say the two women gpo destroy their lives with same mistake.
14-
15 "she dey go deep and deep in her immorality. The image of high Babylonia officer wey dem carve and paint bright red for wall attract her, with decorating cloth round her waist and fancy turban for her head.
16 As she she dem, she con lust and send message go meet dem for Babylonia.
17 The Babylonia come have sex with her. Dem use her and pollute her so much that finally she dey smell to them.
18 She expose herself for public and make everybody know say she be prostitute. I hate her as I don hate her sister.
19 She dey do her prostitute pass before, she dey act as she dey do the time wey she be young woman , even when she be prostitute for Egypt.
20 She dey lust for oversexed men wey get lustfulness of donkey or male horse,"
21 (Oholiah, you wan repeat the immorality wey you dey guilty of when you be young woman for Egypt, where men play with your breast and you loss your virginity.)
22 "Now then, Oholibah, this na wetin I, the Almighty God dey tell you. You don tire for those lovers, but I go make dem angry with you and I go bring them make dem surround you.
23 I go bring all Babylonia, Chaldeans, men from Pekod, Shoa, and Koa, and all Assyrians. I go gather all those handsome young noble men and officers, all those important officers and high " ranking cavalry officer.
24 Dem go attack you from north, and go bring large army with chariot and go supply wagon. Shield and helmet go protect them, and dem go surround you. I go cary you give them and dem go judge you by their own law.
25 Because I dey vex for you, I go let dem deal with you in their anger. Dem go cut your nose and your ear and go kill your children. Yes, dem go take your son and daughter away from you and dem go burn dem alive.
26 Dem go tear your cloth and carry your jewels.
27 I go stop your dream about your love affair with Egypt, you go look for them again. You no go remember Egypt again!"
28 This na wetin Almighty God talk: "I go hand you over to people wey you hate and disgusted with.
29 And because say dem hate you, dem go carry everything wey you don work for and dem go naked you, and expose you like prostitute. Your lust and prostitution
30 don bring this to you. You be prostitute for the nation and don pollute yourself with their idol.
31 You follow your sister footstep, and so I go give you same cup of punishment make you drink."
32 The Almighty God talk say, "You go drink from your sister cup; e large and deep. Everyone go reject and mock you; you cup don full.
33 E go make you dey miserable and drunk, that cup of fear and destroy, na your sister Samaria cup.
34 You go drink and drain am dry, and its broken pieces go tear your breast. I, the Almighty God don speak."
35 Now this na wetin the Almighty God dey say: "Because you don forget me and you against me, you go suffer for your lust and prostitution."
36 God tell me say, "Son of man, say you don ready to judge Oholah and Oholibah? Speak against dem for the bad thing wey they don do.
37 Dey don commit adultery and killing- adultery with idols and killing of children wey dem born for me. Dem sacrifice my children give idols.
38 No be everything wey dem do be that. Dem pollute my Temple and break the Sabbath, wey I don establish.
39 The day wey dem kill my children as sacrifice give idol, dem come my Temple and pollute am!
40 "Again and again dem send messenger go invite men come from great distance, and the men come. The two sister go bathe and put eye shadow and jewellery.
41 Dem go sit on beautiful couch, and and table cover with good things for their front, including incense and the olive oil wey I don give them.
42 "The noise for Jerusalem dey sound like crowd of people wey dey do party. Many people come the party, people don dey drink already as dem come from desert. Dem give the women bracelet and beautiful crown.
43 I talk to myself say dem dey use dem as prostitute woman wey don worn out by adultery.
44 Them go back to this prostitute again and again. Them go back to Oholah and Oholibah, those immoral women.
45 Righteous men go condemn them on charger for adultery and killing and blood don stain their hands."
46 This na wetin Almighty God talk: "Bring mob make he terrorize and rob them.
47 make the mob stone and attack them with sword, make he kill their children, and burn their house.
48 I go stop immorality throughout the land, as warning give every woman make dem no commit adultery as dem do.
49 And una two sisters " I go punish una for una immorality and for una sin for worshiping idols. Then una go know say I be the Almighty God."