Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Ezekiel 2

The voice talk say, "Son of man, stand up. I wan follow you talk."

2 As the voice dey speak, spirit of God enter me and lift me up to my feet and I continue to dey hear the voice,

3 "Son of man, I dey send you go meet the people of Israel. Dem don sin and turn against me and still dey sin, just like their ancestor don do.

4 Dem stubborn and no dey respect me, so I dey send you go tell them wetin I, the Almighty God, dey tell them.

5 whether those people wey disobey listen to you or dem no listen, dem go know say prophet don dey among them.

6 "But you son of man, make you no fear them or anything wey dem say. Dem go disobey and hate you; e go be like say you dey live among scorpion. Still, no fear those wey no dey obey or fear anything wey dem say.

7 You go tell them anything wey I tell you say make you talk, whether dem hear you or not. Remember say dem be people wey no dey obey.

8 "Son of man, hear wetin I tell you, no be like them wey no dey obey me. Open your mouth and eat wetin I go give you."

9 I see a hand stretch out come meet me, and e dey hold paper.

10 The hand open the paper, and I con see wetin dem write for the two sides " Na different kind sad songs, sad stories, and warning dey there.

Open Bible reader