Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Ezekiel 16

1 God speak to me again.

2 He talk say, "Mortal man", "point out to Jerusalem for the bad thing wey she don do.

3 Tell Jerusalem wetin the Almighty God dey tell her: "Na for land of Canaan dem born you. Your father be Amorite, and your mother be Hittite.

4 No one cut your umbilical cord or wash or use salt rub you or use cloth wrap you when dem born you.

5 No one pity you to do any of those things. No one love you when dem born you. Dem throw you out for open field.

6 "Then I pass and see you there for inside blood. Blood cover but no go let you die.

7 I help you gree like plant for field, you grow and strong and become young woman. Your breast don form, and your head don form, but you dey naked.

8 "As I pass again, I see say time don reach make you fall in love. I use my coat cover your naked and I promise say I go love you. Yes, I promise say I go marry you and you become my own. "Na wetin Almighty God talk b this.

9 "Then I use water wash the blood commot. I use olive oil rub your skin.

10 I give you nice dress and soft leather sandal, linen headband, silk scarf.

11 I put jewel for your body " bracelets and necklace.

12 I give you nose- ring and earring and beautiful crown make you wear.

13 You dey beautiful for your silver and gold jewellery, and your linen, silk, and beautiful material, you eat bread wey dem make with best flour, and get honey with olive oil make you eat. Your beauty dey shine, and you become queen.

14 You become popular for every nation for your beauty, because na me make you lovely."Na wetin Almighty God talk be this.

15 "you begin to dey trust in your beauty. You use the good name wey you get and no dey faithful to me. You dey do like prostitute with every man wey pass by, you dey give yourself to all of dem!

16 You use some of your clothe take decorate your place of worship, as prostitute, you carry yourself give everyone.

17 You carry silver and gold jewellery wey I don give you and use dem make male image and dey commit adultery with them.

18 You carry the beautiful clothe wey I give you and put am on top the image, and you carry olive oil and incense wey I give you give the image.

19 I give you food-best flour, olive oil, and honey- but you offer am as sacrifice give idols take win their favour."Na wetin Almighty God talk be this.

20 You even do something wey bad pass that one " Your sacrifice your children give those idols!

21 You kill my children, so you fit give dem as sacrifice.

22 You busy dey sin and dey do prostitute that you no remember the day wey you young and dey roll naked inside your own blood.

23 Now me, the Almighty God talk say. You don enter trouble! No be only these evil things you do

24 but you also build place on street for every corner

25 Where you dey disgrace yourself by having sex with everyone wey walk by. And you dey do am more everyday!

26 To make me vex, you even carry yourself give people of Egypt, who dey always ready to sleep with you.

27 But I punish you but allowing those greedy philistine enemy make dem take some of your territory. Even your bad behaviour dey vex them.

28 You no get enough sex, so you run go meet Assyrian and sleep with dem but you no still satisfy,

29 so you go meet Babylonia, but dem still no satisfy you.

30 This na wetin Almighty God say: "You do all this like shameful prostitute.

31 You build places to dey worship idol for every street and you dey practice prostitution. But you no dey do am for money like other prostitute.

32 You be like woman wey commit adultery with stranger instead to dey love her husband.

33 Prostitute dey collect money, but you dey give present to your lover and dey bribe them make dem come from everywhere con sleep with you.

34 You no be like other prostitute, men no dey ask you for sex- na you dey pay them!

35 Make una listen to me, Jerusalem, you prostitute.

36 You dey run after lovers, then you dey commot your cloth to get sex, you even dey worship rubbish idol and sacrifice your own children give them.

37 So I, the Almighty God go gather all your lovers, those wey you like and those wey you hate, dem go stay around you and I go remove you clothe and allow those lovers make dem see your nakedness.

38 I go condemn you for adultery and murder, and I go punish you to death with my anger.

39 Then I go carry you give your lovers, wey go destroy the place wey you dey have sex. Dem go remove your clothes and jewellery, and go naked you completely.

40 "Dem go gather people to stone, and dem go use sword cut you to pieces.

41 Dem go burn your house and go allow plenty women see your punishment. I go stop you to dey do prostitute and I go stop you to dey give gift to your lover.

42 Then my anger go stop, and I go calm, and I no go jealous or vex again.

43 You don forget how I treat when you dey young, and make me vex with all these things wey you don do. Na the reason why I don make you pay for all of them. Why you add sex immorality to all the bad things wey you don do?" Almighty God don talk.

44 God talk say, "People go use this proverb about you, Jerusalem: "Like mother, like daughter."

45 You be like your mother, wey hate her husband and her own children, you also be like your sisters, wey hate their husband and children. Your father be Amorite, and your mother be Hittite.

46 Your older sister be Samaria, for north, with her villages. Your younger sister, with her village, na Sodom, for north.

47 You dey follow their way of life and their wicked way and soon your own worse pass their own.

48 "As surely as I be living God," the Almighty God talk say, "your sister Sodom and her village never do the kind evil wey you and you village don do.

49 She and her daughter dey proud because dem get plenty to chop and live for peace and quite but dem no gree help the poor and needy.

50 Dem think say dem better pass everyone else, and dem do do things wey I hate and naso I destroy them.

51 You people of samaria don sin twice pass Jerusalem. In fact your evil way don make Sodom and Samaria look innocent.

52 So their punishment no go reach your own. You go be disgrace and put to shame because of your sin.

53 Someday I go bless Sodom and Samaria and their nearby village, I go also bless Jerusalem.

54 You go be ashame of yourself and your disgrace go show your sister how good dem be.

55 Dem go prosper again, and you and your village go be restored.

56 "In the past, you dey proud and dey make fun of your sister Sodom, but you no go do that again.

57 But everyone don learn how wicked you be. The country of Syria, Philistia and other neighbour hate you and dey make insult you.

58 You go pay for offensive and bad things wey you don do. I, God don speak.

59 Jerusalem, you suppose be punish, because you don break your promise and forget our agreement.

60 But I remember the agreement wey I dom ,ake with you when you dey young and so I go make wey go last forever with you.

61 When you think about how you don do, you go be ashamed, especially when I return your sister give you as sister, even though this one no be part of agreement.

62 I go keep this promise and you go know say I be God.

63 I go forgive you, but you go think about your sin and you go be too ashamed to say a word. I, the Almighty God don speak.

Open Bible reader