Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Ephesians 6

1 Shildren, as una no God, mak una dey hear una papa and mama wod, bikos na wetin una sopoz du bi dat.

2 Mak una respet una papa and mama, bikos na dis bi di first komandment from God wey get promis.

3 So dat e go beta for una and una go get long life.

4 Una wey bi papa, mak una nor mak una shildren ves, bot mak una raiz dem to folo di tishin wey Kraist tish.

5 Una wey bi savant, mak una dey obey una masta wit fear, respet and wit klin maind laik sey, na Kraist una dey obey.

6 Mak una nor bi laik pipol wey dey du dia wok wen dem si sey, pesin dey luk dem; bikos dem dey fine gud face. Insted, as una bi Kraist savant, mak una dey du wetin God laik from una heart.

7 Mak una dey du una wok wit beta maind laik sey, na Kraist una dey du-am for and nor bi humanbin,

8 bikos una no sey, ish pesin; weda e bi slave or e dey fri, if e du wetin dey gud, Kraist go riwod am.

9 And una wey bi masta, mak una dey trit una savant wel. Mak una nor mak dem fear, bikos both yu and dem get di same masta for hevun and E nor dey favor enibodi enihaw.

10 Finali, mak una dey strong wit Kraist mighti pawa.

11 Mak una wear komplit soja uniform wey God dey giv, so dat una go fit stand fite di wayo wey devol dey yuz.

12 Bikos, wi nor dey fite against humanbin, bot na against di wiked rulas wey dey for dis wold, against evil spirits and pawas wey dey di hevuns.

13 Na dis mak mi sey, mak una wear komplit soja uniform wey God dey giv, so dat una go fit stand for groun wen trobol and wahala go kom and wen una don win, una go stil stand wel.

14 So, mak una stand wel-wel kon tie trut laik belt roun una waist, den wear bullet proof koat as raitiousnes for una bodi.

15 Mak una wear shu for leg wey go show sey, una dey redi to prish di Gud News wey dey giv pipol peace

16 and wit all dis, mak una kari fate wey go help una kwensh all di wiked arrows wey Satan dey trow.

17 Mak una wear salvashon laik cap for head kon hol di Spirit sword wey bi God wod.

18 Wit difren prayas, mak una dey ask God to help una. Mak una always dey pray wit di Spirit and dey shine una eyes wel-wel. Mak una nor giv up, bot mak una kontinu to pray for all God pipol.

19 Mak una pray for mi tu sey, mak God giv mi beta wod enitaim wen I opun my mout to tok and mak I fit esplain di sikrit wey dey di gospol.

20 I bi God mesenja, ivun doh I dey for prizin naw. Bot mak una pray sey, I go dey tok wit boldnes as I sopoz to tok.

21 Tikikus wey bi my special broda and fateful savant for God wok, go tel una evritin, so dat una go no wetin dey hapun to mi for here.

22 Na bikos of dis I send am kom mit una, mak una for no haw tins dey wit us for here and mak e for fit enkorage una heart.

23 I pray sey mak God, awa Papa and Oga Jisos Kraist giv all my felow Kristen brodas and sistas peace, luv and fate.

24 Mak God grace dey wit evribodi wey luv awa Oga Jisos Kraist wit di luv wey nor dey die.

Open Bible reader