Nigerian Pidgin Bible
Ephesians 3
1 Bikos of dis, mi, Pol wey bi prizina for Kraist, bikos of una wey bi Gentai pipol, dey pray giv God.
2 Tru-tru, una don hear sey na God giv mi dis wok tru en grace and na for una own gud.
3 God opun my eye to undastand en sikrit, as I rite to una bifor,
4 so dat wen una read am, una go fit undastand di sikrit wey God show mi.
5 Di pipol wey dey bifor nor no dis sikrit as God don show en holi apostols and profets wey dey naw, tru di Holi Spirit.
6 So, bikos of di gospol, Gentai pipol don folo Ju pipol get share for God blessin. Dem don bi membas for Kraist bodi and dem get share for God promis.
7 I bi dis gospol savant, bikos of God grace wey E giv mi tru di wok wey en pawa dey du.
8 Na mi smol pas for all God pipol, bot God don giv mi grace to prish di Gud News giv Gentai pipol and dis grace wey Kraist giv mi, nor dey finish.
9 Di grace na to mak evribodi undastand God sikrit plan. Na God kreate evritin and E hide di plan since e kreate di wold.
10 E mak dem undastand, so dat tru di shosh, all di rulas and pawas wey dey hevun go kon no God komplit wisdom, wey dey show ensef for difren ways.
11 Dis hapun akordin to en plan wey go stand foreva and E mak am hapun tru awa Oga Jisos Kraist
12 and na bikos Kraist dey fateful, naim mak us get di heart to fit rish wer God dey.
13 Na dis mak mi tel una sey, mak una nor fear bikos of di tins wey I dey sofa, bikos na for una own gud.
14 Bikos of dis, I dey nil dan for awa Papa front,
15 wer all di famili for hevun and eart from get dia names.
16 I dey pray sey as en glori big rish, E go mak una strong wel-wel wit pawa tru en Spirit wey bi di ril pesin insaid una.
17 So dat Kraist go dey insaid una heart tru fate and wen una don strong wel-wel insaid God luv,
18 una go fit join all God pipol undastand haw God luv wide, long, high and deep rish.
19 Den una go rili no di luv wey Kraist get, wey big pas evritin wey una go fit undastand and evritin insaid God, go ful una life.
20 So, mak all di glori bi God own; di Pesin wey dey du pas di tins wey wi go fit ask or tink, tru en pawa wey dey wok insaid us.
21 Mak all glori for Kraist shosh bi en own from generashon to generashon. Amen!