Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Ephesians 1

1 Dis leta na from Pol, wey bi Jisos Kraist apostol, bikos na so God wont am. I dey rite to God pipol wey dey for Efisos, di wons wey dey folo Jisos Kraist wit fate.

2 Mak di grace and peace wey dey kom from God awa papa and from awa Oga Jisos Kraist, dey wit una.

3 I bless God wey bi awa Oga Jisos Kraist Papa; wey don bless us wit difren spiritual blessin from hevun, bikos of Kraist.

4 Bifor God kreate di wold, E shuz us tru Kraist bikos E luv us, so dat for en front, wi nor go get eni fault and wi go dey holi.

5 Bifor, God don alredi decide tru Jisos Kraist sey, wi go bi en shildren, bikos na so E wont am.

6 So, mak all praiz and glori bi en own, bikos of en fri grace wey E giv us, tru en pikin wey E luv wel-wel.

7 Na tru Kraist blood wi tak get salvashon and na dis blood mak God dey forgiv us awa sins, bikos en grace big wel-wel.

8 Di grace wey E giv us, get plenti wisdom, sense and undastandin.

9 E du laik dis wen E show us di sikrit plan wey E get and di gud maind wey E show evribodi, tru Kraist.

10 God go komplit en plan wen di taim don rish, den E go gada evritin wey dey hevun and eart togeda unda Kraist, wey bi di head.

11 All tins dey hapun as God wont am and tru Kraist, E shuz us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di taim wen E kreate di wold,

12 so dat wi wey first biliv Kraist, go dey giv am praiz and glori.

13 Since una don hear di trut kon biliv Kraist, God don giv una di Holi Spirit as special mark to show sey naim get una.

14 God deposit dis Holi Spirit for di tins wey wi go inherit, ontil di taim wen E go save en pipol, so dat all praiz and glori go bi en own.

15 So, since I hear abaut una fate for Kraist and haw una luv all God pipol,

16 I nor dey stop to tank God for una, wen eva I dey pray.

17 I pray mak God, awa Oga Jisos Kraist Papa wey get glori, giv una spiritual wisdom and revelashon, wey go mak una no am wel-wel.

18 Una eye don opun to undastand di grace wey God kol una kom enta and una don si haw di blessin wey E promis en pipol, plenti rish.

19 Una don si haw en pawa big rish, bikos una biliv am. Dis na di pawa wey dey du big-big tins for us.

20 E show dis pawa tru Kraist, wen E raiz-am from deat, kon mak am sidan for en rite hand for hevun;

21 di place wey far wel-wel, wey high pas wer wiked pipol dey rule; wey strong pas evri pawa wey dey dis wold; big pas evri name wey dey for dis wold and di wons wey dey kom.

22 God put evritin unda Kraist leg, kon mak am head for di shosh and Oga for evritin.

23 Na di shosh bi Kraist bodi and naim dey mak evritin for evriwer ful and komplit.

Open Bible reader