Nigerian Pidgin Bible
Deuteronomy 24
1 Suppose say a woman first husband don divorce her because he find out a secret wey he no like about the woman. Naso he write divorce letter, give am to her, and send her away.
2 She later marry another man,
3 wey come divorce her same way or die.
4 Since she don sleep with her second husband, she no fit marry her first husband again. Their marriage go pollute the land wey the LORD una God dey give una, and he no go like am.
5 If a man and woman marriage never reach one year, make una no send him go war or send him make he go do hard labor. Make una allow him stay one year for house and dey happy with him wife.
6 When una borrow person money, una fit keep something wey belong to the person as guarantee say the person go pay back the money. But make una no take one or the two of their grinding stone, or else hunger fit kill them. Dem need the stones to dey use grind grain to flour to make bread.
7 If una dey guilty say una kidnap Israelites or force them enter slavery, dem go kill una so that dem go remove this evil from the community.
8 I don tell the priest wetin to do if any of una get leprosy, so make una do exactly wetin dem talk.
9 And make una remember wetin the LORD una God do to Miriam after una leave Egypt.
10 When una borrow people money, una fit take something wey be their own as guarantee say dem go pay back. But make una no enter their house to get am.
11 Make una wait outside, and dem go bring out wetin una don gree on.
12 Suppose say someone dey poor so tey the only thing wey him get to give as guarantee to borrow money na a coat. Make una no keep the coat overnight.
13 Instead, make una give am back for evening, so that the owner fit keep warm and sleep and ask God to bless una. Naso the LORD una God go notice say una don do right thing.
14 If una hire poor people to work for una, make una no owe them money, whether dem be Israelites or foreigners wey dey live for una town.
15 Make una pay them their labor money for end of each day, because dem dey live in poverty, and dem need money to survive. If una no pay them on time, dem go complain about una to God, and he go punish una.
16 Make una no kill parents for the crime wey their children commit, and make una no kill children for their parent crime. Make una no kill anyone for another person crime.
17 Make una dey sure say una treat orphans and foreigners well. And if una borrow widow money and una wan keep something wey be her own as guarantee say she go pay una back, make una no take any of her cloth.
18 Una be slaves for Egypt until the LORD una God rescue una. Na why I dey give una these laws be that.
19 If una forget to bring a bunch of grain wey una don harvest, make una no go back to field to get am. Leave am for the poor, with foreigners, orphans, and widows, and God go make una successful for everything wey una do.
20 When una harvest una olives, make una no try get all of them for only unaself, but make una leave some for the poor.
21 And when una pick una grapes, make una do am once, and allow the poor take wetin remain.
22 Una live in poverty as slaves for Egypt until the LORD una God safe una. Na why I dey give una these laws be that.