Nigerian Pidgin Bible
Deuteronomy 16
1 Moses talk say: People of Israel, una must celebrate Passover for month of Abib, because one night for that month years ago, the LORD una God rescue una from Egypt.
2 The Passover sacrifice must be a cow, a sheep, or a goat, and una must offer am for the place where God choose for una to dey worship him.
3-
4 Make una eat all the meat of the Passover sacrifice for that same night. But make una no serve bread wey una make with yeast for Passover meal. Make una serve the same kind thin bread wey una dey eat wen una dey suffer as slaves for Egypt and when una need to leave Egypt quickly. As long as una dey live, this thin bread go remind una of the day una leave Egypt. For seven days wey follow Passover, make una no make any bread with yeast. In fact, make yeast no dey anywhere for Israel.
5 Make una no just dey offer Passover sacrifice for any town wey una dey live.
6 Na where God choose for worship una must offer am. Make una kill the sacrifice for sunset, the time of day when una leave Egypt.
7 Then cook am and eat am there for the place of worship, and make una return to una tent next morning.
8 Make una eat thin bread for next six days. Then on the seventh day, make una no do any work. But, make una come together and worship the LORD.
9 Seven weeks after una start una grain harvest,
10-
11 make una go to the place where the LORD choose for una to dey worship him and celebrate the Harvest festival to honor the LORD una God. Make una bring offering as large as una fit bring, depending on how the harvest he don give una big reach. Make una dey sure say una take all una sons and daughters and all una servants. Invite the poor, the Levites, foreigners, orphans and widows.
12 Make una remember say na slave una be for Egypt before, so make una obey these laws.
13-
15 After una don finish the grain harvest and the grape harvest, make una take una sons and daughters and all una servants to the place where God choose for una to dey worship him. Celebrate Festival of Shelters for seven days. Make una also invite the poor, the Levites, foreigners, orphans, and widows. God go give una big harvests and make una successful for everything una do. Una go dey fully happy, so make una celebrate this festival to honor the LORD una God.
16 For each year, e get three festivals when all Israelites men must go to the place where God choose for una to dey worship him. Na them be the Festival of Thin Bread, the Harvest Festival, and the Festival of Shelters. And make una no forget to take gift with una for the LORD.
17 As una harvest big reach, naso make una gift big reach.
18-
19 After una don settle for the town wey una go receive from the LORD una God, make people for each town appoint judges and other officers. Una wey become judges must dey completely fair when una make legal decisions, even if person wey dey important be part of the case. Make una no collect bribe to give unfair decision. Bribes dey keep people wey wise from seeing the truth, and e dey turn honest people into liars.
20 People of Israel, if una wan enjoy long and successful life, make una dey sure say una dey treat every person with justice for the land God dey give una.
21 When una build the altar to dey use offer sacrifice to the LORD una God, make una no set up sacred poles for the worship of the goddess Ashera.
22 And make una no set up sacred stone! God hate these kind things.