Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Amos 7

1 I get vision from Almighty God. For the dream I see him create plenty locust after dem don cut the king share of hay and the grass don start to dey grow again.

2 For my vision, I see the locust dey chop every green thing wey dey the land, and then I talk say, "Almighty God, forgive your people! How dem fit survive? Dem dey small and weak!"

3 God con change him mind and talk say, "Wetin you don see no go happen."

4 I get another vision from Almighty God. For the vision, I see him dey prepare to punish him people with fire. The fire burn the great ocean wey dey under the earth, and start to dey burn the land.

5 Then I talk say, "Stop, Almighty God! How your people go fit survive? Dem small and weak!"

6 God change him mind again and talk say, "this one too no go happen."

7 I get another vision from God. For this vision I see him dey stand beside a wall wey dem build with help of plumb line, and plumb line dey for him hand.

8 He ask me say, "Amos, wetin you see?" I answer am say, "I see Plumb line". Then he talk say, "I dey use am show say my people be like wall wey don commot for line. I no go change my mind again say I go punish them.

9 The place where Isaac descendant dey worship go destroy. The holy place of Israel go destroy. I go end king Jeroboam family."

10 Amaziah, wey be priest of Bethel, send report to king Jeroboam of Israel say: "Amos dey plot against you among people. Wetin he dey talk go destroy the country.

11 Na wetin he say be this: "Jeroboam go die for battle, and dem go take people of Israel commot from their land go foreign land.""

12 Amaziah tell Amos say, "E don do, prophet! Go back to Judah make you go do your preaching for there. Make dem pay you for am.

13 No dey prophesy for Bethel again. Na king place of worship be this, the national temple."

14 Amos con answer am say, "I no be the kind prophet wey dey prophesy for pay. Na herdsman I be, and I dey take care of fig tree.

15 But God take me commot for my work as shepherd and command me make I come prophesy to him people Israel.

16 So now hear wetin God dey talk. You tell me make I stop to dey prophesy, make I stop to dey speak against people of Israel.

17 And so, Amaziah, God tell me make I tell you say, "Your wife go become prostitute for street, and your children go die for war. Dem go divide your land and give am to others, and you self go die for foreign country. And e dey sure say, dem go take people of Israel commot for their land go foreigner land.""

Open Bible reader