Skip to content

Nigerian Pidgin Bible

Amos 6

1 How bad e go be for una wey get that kind easy life for Zion and for una wey dey feel safe for Samaria- una wey be great leaders of this great nation Israel, una wey people dey come meet for help!

2 Make una go look the city of Calneh. Then go great city of Hamath and go down to Philistine city of Gath. Shey dem better pass kingdom of Judah and Israel? Shey any territory dey wey big pass una own?

3 Una no gree believe say a day of disaster dey come, but wetin una dey do just dey bring that day close.

4 How terrible e go be for una wey lie down on top una fine chair, una dey chop dey enjoy ram meat and lamb!

5 Una like to dey compose song, as David dey do, and use harps play them.

6 Una dey use bowlful dey drink win and una dey use perfume wey fine, but una no mourn say Israel don destroy.

7 Na una go be first to go strange land. Una feast and celebration go end.

8 Almighty God don give this warning say; "I hate Israel people pride; I hate their fine mansion. I go give enemy their capital city and everything."

9 If na ten men remain for family, dem go die.

10 The dead man relative, the one wey dey in charge of funeral, go carry the body commot for house. The relative go call for people wey remain for house, "Sey anybody still dey there with una?"

11 When God give command, house wey big and small go destroy to pieces.

12 Shey horse dey gallop on top rock? Shey anybody dey plough sea with oxen? Yet una don turn justice to poison, and una don turn right to wrong.

13 Una brag say una don capture town of Lodebar. "Una brag sey, "We dey strong to go take Karnaim."

14 The LORD God Almighty himself talk say, "People of Israel. I go send foreign army make dem occupy una country. E go oppress una from Hamath pass for north go brook of Arabah for south."

Open Bible reader